Tributes pour in for Nollywood star Alexx Ekubo wey die at age 40

Read am in 4 mins

'Rest on Alex' don dey trend for social media as tori of di death of di Nollywood star begin spread.

Tori bin break say Alexx Ekubo wey be 40 years old die for hospital on Tuesday.

Im family, management or guild of editors neva tok anytin – tributes don already begin pour in from im colleagues for di Nigerian movie industry.

Fellow actor and feem producer, Funke Akindele wey write for her IG stories say, "Rest In Peace Alex".

Dem bin act togeda for one feem wey drop for 2020, wey dem call Omo Ghetto - The Saga.

Dis tori dey come afta many pipo for di Nigerian feem industry bin dey drop cryptic message about di 40 year old man im life.

Di Nollywood star wey start to dey act for di 2010s bin neva post for im social media in almost two years but bin dey active in acting.

Funke Akindele, Rita Dominic, Bolanle Ninalowo and many odas dey react to Alex passing.

Alexx Ekubo wey bin dey active and lively suddenly stop to post tins ontop social media.

Checks show say na December 2024 e last make any post for social media, sometin wey spark many concerns among im plenty fans.

Di cause im death neva really clear but tori be say e bin dey sick.

Alexx Ekubo profile

According to im bio ontop im official website, dem born Alexx Ekubo for April 10, 1986 for Port Harcourt, Rivers State Nigeria.

E bin train as lawyer for di University of Calabar, but na inside acting e really shine and later see fame.

Alexx win best supporting actor for di 2013 Best of Nollywood Awards ontop im role inside di feem Weekend Getaway.

For 2018, e gbab Special Recogition Award from di Nigerian First Lady say dem dey torchlight im contribution to di development of di Nigerian Entertainment Industry.

For 2020, Alexx bin dey inducted into di MIPAD/United Nations (Most Influential People of African Descent) Top 100 under 40 years hall of fame.

Alexx bin reveal anoda of im achievement as di governing council of the Institut Supérieur de Communication et de Gestion (ISCG UNIVERSITY) confer am wit Doctorate (Honorary) Degree in Arts & Culture for 2021.

E bin also collect di Nigerian National Award of Excellence wey im bin get for im charity work as di Global Social giving actor of di year.

Although im first major role as actor na Ladies Men.

As actor, Alexx get 116 credits for im feem role.

Di latest feem wey comot wit am comot for February dis year wey dem call Adanne.

Oda feems na Áfàméfùnà: An Nwa Boi Story, A Sunda Affair, Hire a Woman, Omo Ghetto - The Saga among odas.

Di 40 year old acor don collect nine awards wey im don collect ova di course of im career.

E bin collect di Black Entertainment Film, Fashion, Television, & Arts Award, London (BEFFTA) for Nollywood Rising Star and di Screen Nation Film & Tv Award (London) for Favorite Male African International Emerging Screen Talent for 2014.

For 2015, e collect di Nigerian Teen Choice Award for Outstanding TV Personality.

For 2016, e bag Best Actor of di year from Best of Nollywood and Model Actor of di year from di Nigerian Model Achievers Award.

For 2022, e win Best Lead actor for di Best of Nollywood and di Best Actor of di year from di Toronto International Nollywood Film Festival.

For 2024, e bin dey nominated for AMVCA for Best Supporting Actor for im role inside di feem, Áfàméfùnà.