You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Nigeria get third highest number of students wey don japa – Report
Nigerian students come third position of di amount of kontri pipo we dey japa to go find education just behind China and India.
Dis na according to di Highter Education Global trends report wey di United Nations Educational, Scientific and Cultural Organization bring come out.
Di report tok say Nigeria make up five percent of all students wey dey japa togeda for world.
China get di most amount of students of 37% while India na di second most wit 29% of sudents.
Meanwhile, Nigeria draw for third position wit Germany wey dey also japa five percent of students to go study abroad.
Di list show say almost half of all di students wey japa to study for 2023 comot from just 10 kontris, say di 10 kontris make up 45% of sudents wey japa to travel.
Dem include:
China (People's Republic) — 37%
India — 29%
Nigeria — 5%
Germany — 5%
Vietnam — 4%
Uzbekistan — 4%
United States of America — 4%
France — 4%
Pakistan — 4%
Nepal — 4%
According to UNESCO di amount of international students don dey rise world wide even wit di pause wey COVID 19 pandemic bin do.
Di report say di number of internationally mobile students for world don grow times three ova di last 20 years as e rise from 2.5 million for 2002 to 7.3 million for 2023 and projection show say e fit reach nine million students by 2030.
But even wit all di growth, na just three per cent of higher education students worldwide dey japa wella from dis global education markey.
Dem come add say di bigger majority of di students wey dey japa dey comot from different parts of Asia as Asia make 47 of japa students.
Di report tok say, "even wit di growth expectations, di proportion of higher education students wey dey benefit from academic mobility stll dey low. E dey under 3%. Dis one torchlight di elitist nature of mobility as na only priviledged few pipo fit get access to higher education opportunities worldwide."
But wetin come dey cause dis trend of japa for education?
Well according to UNESCO, di global outbound mobility trends fit be sake of tins like macroeconomic conditions, di quality and capacity of domestic higher education systems, govment policies, visa regulations, and post-graduation work opportunities.