Wetin be di health benefits of Baobab fruit

Baobab fruits

Wia dis foto come from, Rosita So/Getty Images

    • Author, Abubakar Maccido
    • Role, Reporter
    • Reporting from, Kano
  • Read am in 3 mins

Baobab na big African tree, wey pipo dey call "Tree of Life." E dey grow for dry area for Africa and e popular well-well sake of wetin pipo dey use am do, especially for food and traditional medicine.

Some key part of baobab na di hard fruit wey get dry pulp and seed, leaf wey pesin fit chop, seed wey get plenty oil, and bark wey dem dey use do rope and traditional medicine.

"Baobab fruit get plenty 'vitamin C' even pass orange," Dietitian Ibrahim Abdulsalam Bichi tok.

E add say, "E dey help body strong and make pesin no dey sick".

Health benefits of Baobab fruit

  • Boosts immune system: Baobab fruit pulp get plenty vitamin C, fiber, calcium, potassium and antioxidants, wit small tangy taste; dem dey turn am to powder for pap, smoothie or drink, while di leaves wey also get nutrients dem dey use am cook soup or make herbal tea.
  • E dey help body produce more white blood cells: White blood cells, wey be like soldier wey dey fight germs and E dey make dos white blood cells work better and protect dem from damage, and E dey help wound heal fast so bodi go recover quick wen pesin wound.
  • Improves digestive health: Baobab get plenty fiber wey good for your stomach and intestines, e dey help person dey poop well so constipation no go catch you.
  • Supports bone strength: Baobab get important minerals like calcium, magnesium, and phosphorus. Dem dey help bone strong and healthy.
  • Baobab help control blood sugar: Baobab get fiber and natural plant chemical wey dey slow down how sugar dey enta your blood afta you chop.
  • Baobab fights inflammation and oxidative stress: Baobab get antioxidants and plant compound (dem dey call am polyphenols) wey dey protect bodi from damage.
  • Baobab help body absorb Iron: Baobab get plenty vitamin C, and vitamin C dey help bodi absorb iron from food wey you chop.
  • Boosts iron levels: Baobab dey help bodi get more iron for blood.
  • Hydration and electrolyte balance: Baobab fit help keep bodi hydrated and balance electrolytes, sake of say baobab get natural sugar and fiber, e fit help water stay inside bodi longer, just like oral rehydration drink.
Baobab fruit

Wia dis foto come from, Getty Images

Nutritional value of baobab fruit powder (per 100g)

Energy: 250–300 kcal

Fiber: 50g

Vitamin C: 169–288 mg

Calcium: 375–546 mg

Potassium: 1,000–1,300 mg

Magnesium: 350–552 mg

Iron: 9–57 mg