Doctor breakdown Taiwo Awoniyi injury as im come out of coma

    • Author, Sami Mokbel
    • Role, Senior football correspondent
  • Read am in 5 mins

Nottingham Forest forward Taiwo Awoniyi don wake up from induced coma afta doctors do surgery to repair one serious abdominal injury.

Dem carry Awoniyi go hospital on Monday, afta im bin collide wit goalpost towards di end of dia match wit Leicester City wey finish on Sunday.

BBC Sport hear say di injury Awoniyi get na ruptured intestine.

Afta im do di first part of di surgery on Monday, di striker spend Tuesday for induced coma as medical staff monitor im progress as part of di procedure.

Awoniyi do di second stage of di operation, including closing of di wound, on Wednesday.

Dem wake am from di induced coma for early evening.

Forest say dem go open internal review on dis Awoniyi injury mata.

Awoniyi bin receive long medical attention for pitch afta di collision, and im bin look like say im bin tell di medical team say im no go fit kotinu.

E bin later show say im bin still dey feel di effects of di collision, but im stay on for field. By dat stage, dia head coach Nuno Espirito Santo bin don field all im substitutes for di match.

Forest owner Evangelos Marinakis bin enta pitch afta di game to express im concern to Espirito Santo ova how dem handle Awoniyi.

Dis na sake of fears regarding di forward health as TV footage clearly show say di Nigerian player bin dey uncomfortable.

Tori be say di club go wan establish di facts around why Awoniyi bin dey allowed back on for field to play.

For di medical statement wey forest bin release on Tuesday, dem confam Awoniyi surgery, and tok about di "shared frustration between all of dem say di medical team no suppose allow di player to kotinu".

Nigeria super Eagles bin post picture of Awoniyi wit dis words '' Get well soon Taiwo Awoniyi''

While Super Falcons captain Rasheedat Ajibade say ''Praying for you Taiwo ''.

'Potentially life-threatening'

Speaking to BBC Sport, consultant colorectal surgeon Professor Gillian Tierney say injuries wey dey similar to di one wey Awoniyi suffer fit dey fatal.

"Di injury dey really serious. Na potentially life-threatening," injury na so Tierney tok

"E dey very easy to miss at di point of contact and e fit take hours to diagnose.

"For hospital setting, we go send a patient for a CT scan wey fit take up to 10 hours.

"If e happun to athlete wey dey super fit, very muscular and dey run on adrenaline den I feel say e go dey extremely understandable to miss am. Fluid wey dey leak from di intestine no dey easy to diagnose straight away.

"E usually dey require surgery wia dem go open up di stomach. Di mortality stat na 9%. So if athlete – wey dey really fit do di procedure – dem go stand a good chance of being OK.

"E go dey different if di operation occur for an 80-year-old, wey get oda health issues."

Oga Harpaul Flora, wey be consultant vascular and general surgeon for London Clinic, say ruptured intestines na "very rare injury".

Im add say: "Na either a compression of di abdominal wall wey lead to tearing and liquid dey seep out - or na tear of an artery.

"Neither of dem go fit dey diagnosed without a scan, dem fit get bruising.

"E fit be life-threatening. If dem no treat am for hospital, e fit give you infection. E fit den lead to sepsis, wey be life-threatening consequence."

Di 'late flag' offside law expose Awoniyi to serious injury?

Di injury wey Awoniyi suffer don raise kwesions about di future of di offside law.

Awoniyi bin dey attempt to reach Anthony Elanga cross wen im get di injury. Replay bin show say Elanga bin dey offside for di build-up.

Di International Football Association Board (IFAB) bin introduce one new law on offsides for di 2020-21 Premier League season following di introduction of di video assistant referee (VAR).

While di law neva change, dem tell assistant referees to keep dia flag down if dem feel na goal scoring opportunity.

"Wit di introduction of VAR, na im di process start for assistant referees dem to delay to raise dia flag to indicate offside until di outcome – na either a goal or possession of di ball by di defence," former Premier League referee Keith Hackett tell BBC Radio 5 Live.

"Dis na to ensure say wia di assistant referee make mistake for offside decision, e no go affect di decision to rule out di goal incorrectly. Sadly, dis practice dey expose players to di risk of injury."

Former England women midfielder Fara Williams don hala say make dem review di law.

"Wen e dey marginal, I understand. Wen offside dey so clear and obvious, I feel say na di duty of di assistant referee to put dia flag up and stop play," Williams tell BBC Sport.

"For dis scenario, e happun from di halfway line. Dis na time bomb waiting to go off in terms of someone to dey seriously injured. Awoniyi get dis horrific injury because of dis.

"I dey totally against am and I feel say most players dey against am as well. Na a rule wey nobody like and I sure say dem go look into am dis summer."

Who be Taiwo Awoniyi?

Taiwo Awoniyi na Nigeria international wey dey play im club football for English Premier League side Nottingham Forest.

Awoniyi join Nottingham Forest for June 2022 from Bundesliga side Union Berlin.

Di 27-year-old striker start im professional career wit Liverpool for 2015 bifor im enjoy loan spells for Germany, Holland and Belgium.

Awoniyi score im first goal for di Reds for dia 1-0 win against West Ham United for August 2022.

For di start of di 2023 season, Awoniyi bin score for di first three matches to surpass Stan Collymore as di first player for di club history to score in seven consecutive Premier League fixtures.

Awoniyi na di third African behind Emmanuel Adebayor and Mohamed Salah to score for seven consecutive Premier League fixtures.

Dis season im don score two goals for Nottingham Forest.

Di striker don represent Nigeria for several age grade competition bifor and don play several times for senior men national team, di Super Eagles.

Awoniyi bin dey part of di Nigeria team wey beat Libya 1-0 for dia 2025 Afcon qualifying match for Uyo wey Dele Bashiru score.

Di striker dey married to Taiye and di couple get a son togeda.