Lagos power outage - which areas e go affect and wetin you fit do about am

Wia dis foto come from, PHILL MAGAKOE/ Getty Images
Di Nigerian Electricity Regulatory Commission, NERC and di Nigeria Independent System Operator, NISO don gree make di Transmission Company of Nigeria, TCN upgrade one of dia 30kV lines wheeling bulk power.
Dem wan install Optical Ground Wire (OPGW) fibre cable for di Omotosho/Ikeja West 330kV transmission line.
Dis na di places wey go dey affected from di 28th of July to di 21 of August from 8am to 5pm.
- Ojodu
- Oke-Ira
- Agidingbi
- Omole Phase 1 & 2
- Iju
- Berger
- Magodo (Phase 1 & 2)
- Ketu
- Oregun
- Ojota
- Some areas for Agege
- Ifako
- Abule Egba
- Ojo
- Ikeja
- Oshodi
- Ayobo
- Alimosho
- Ogba
- Alausa
- Ejigbo
Even Eko Electricity Distribution Company (EKEDC) say dia customers go experience irregular power supply sake of di maintenance work TCN wan carry out on di Omotosho – Ikeja West 330kV transmission line, but dem no tok dis exact areas wey go dey affected.
So how pipo wan take deal wit di nine hours of no light evriday for a month.
- Di major tins wey fit suffer for dis power outage, na tins wey pesin dey refrigerate. One of di tins wey you fit do na to get block so di tins wey you keep for your fridge go stay chilled.
- You fit use generator wit fuel for nine hours wey fit cos about N10,000 per day, depending on di capacity of di generator and di load wey di generator dey carry.
- Anoda tin wey pipo wey dey work from home dey advice na solar inverter, or inverter batteries to save some of di energy wey go dey wen di light dey on. Simple search show inverter batteries, dey cost between 50,000 and ova 300,000 naira but di one wey go co wit solar panels dey between one to five million naira
- Anoda issue, wey pipo fit face wen dem no get light na di death of dia communication phones, like handsets, etc.One of di advice for dat one na say charge am for office bifor you reach house. For pipo wey no dey do office job, places dey for market wey go charge you money to charge your devices. Di only warning dia na make you torchlight your devices wella.
All in all, na money e go take to really accomodate all di tins wey fit sup sake of dis light outage.

Wia dis foto come from, Carolyn Van Houten/ Getty Images
Wetin TCN wan do wey dey make dem power off
Di Disco companies explain say di reason for di partial blackout na sake of scheduled maintenance wey di Transmission Company of Nigeria wan do di Omotosho-Ikeja West 330kv powerline, and di maintenance go affect di load shedding across dia networks.
Di maintenance go involve upgrade of operations for Omotosho–Ikeja West 330kV transmission area, and dis na one important power transmission channel for Nigeria power grid system.
Di line dey serve as key conduit between di Omotosho Power Station for Ondo State and Ikeja West, wey be major power transmission hub for Lagos State.
Ikeja Electric and EKEDC don inform residents within dis coverage areas to expect load management measures throughout di maintenance period, wey fit affect residential, commercial, and industrial during working hours.
For Lagos residents during di peak hour wen power supply go dey dem go need to schedule dia activities and business around di blackout.









