Ghana @67 - Wetin president Akufo-Addo tok for di kontri independence anniversary

Wia dis foto come from, Getty Images
Na for dis day, 1957 wey Ghana don gain independence for di hand of di British colonial goment.
Sixty seven years ago, di kontri first president Osagyego Dr Kwame Nkrumah and di oda ogbonge pipo wey struggle for di freedom of di kontri, don declare say “Ghana, your beloved kontri dey free forever.”
Dis declaration don mark di journey wey Ghana don pursue, afta di colonial masters lerf di kontri.
Di kontri don chop 67 years on Wednesday.
For one event wia dem dey organize every year to mark di anniversary, president Akufo-Addo tok say Ghana don be beacon of democracy for di continent.
Na so di citizens for ensure say dis tag continue to remain.
“We don be democratic kontri, everibodi no go fit boast of dis tag, wetin we get today, na we work hard pursue am,” di president tok.
Im add say “everytin we sabi about elections, we don learn am di hard way ova di last 31 years wia we don dey stable.”
End of Di one wey oda users dey read well well
As di kontri don dey prepare for anoda election for December, president Akufo-Addo explain say “we for neva copy kontris wia scatter sake of disputed election.”
Im wan make di electoral process transparent, despite say technology go fit make am easy for pesin to manipulate di process.
Im also “dey easy to use dis technology for fake news and propaganda. But we for don dey careful.”
According to Akufo-Addo, pipo still gatz tins to learn about say make dem tolerate oda pesin opinion.
On di kontri economy wia scatter, di president tok say im know say wahala dey, but tins go better.
“We don go thru wahala but e don dey clear say we don overcome di worst.”
Di 67th independence parade wia happun for di eastern region, di president im hometown, don attract ogbonge pipo, school pickin, market women and oda pipo wia dem march.
Cote D’ivoire president, Alassane Outarra na special guest of honour for di independence anniversary.
Oga Outarra tok say di two kontris get plenti tins in common.
Im add say Ghana don show di way to many oda Africa kontris say dey too fit gain independence for dia colonial masters.
Oga Ouattara tok say “Ghana don achieve many tins despite say plenti wahala dey for di global level, wit covid and di Ukraine war togeda wit di problem for Gazza.”
“We and Ghana don be friends wia dat friendship go continue even as you don dey celebrate 67 years of independence,” oga Ouattara add.













