Man chop life imprisonment for baffing im girlfriend wit acid becos she reject im marriage proposal

Woman dey hide for dark room

Wia dis foto come from, Getty Images

One Calabar High Court sentence 33 year old Jide Afolayan Sunday to life imprisonment afta dem find am guilty of attempted murder.

Dis dey come afta Sunday bin pour im girlfriend acid sake of say she no gree marry am.

Justice Blessing Egwu order Sunday say make e pay ten million naira to Glory Sylvester Ita as compensation on top di life prison sentence, for her surgery.

Tori be say for di Justice statement, di prosecution bin prove dia case of attempted murder by pouring acid. Say di attack bin dey well planned.

Sunday don dey for police custody for months and tori be say e bin pour di acid from her head to her stomach and leave her wit ogbonge burns for her ears and breast.

Dem also add say e bin wound her finger and bin even try throw Ita for pool so she go drown.

Cross River Judiciary

Wia dis foto come from, Cross River Judiciary

For trial, prosecution claim say di mata bin start becos of breakup.

Di tori be say Sunday invite Ita go one Calabar hotel on 21 October, 2022 and from dia fight start wey lead am to pour acid for im babe face.

Prosecutor say, di couple bin dey date for nine months bifor Sunday ask Ita to marry am but she no gree and bin wan call off di relationship and na dat time acid enta di mata.

But wen dem arrest Sunday, e deny di accusation say no be so tins dey happun.

E even claim say na she pour acid for im bodi but evidence prove say no be so e happun.

By January 24, dem don arrest and charge Sunday go court.

Acid attacks in Nigeria

Wetin we call dis Video, Acid survivor: Francess Obanye reveal how her uncle wife pour her acid sake of jealousy

Francess Obanye, anoda acid survivor bin follow BBC Pidgin about how dem bin pour acid for her bodi and dem no even catch di pesin wey do am.

While dem be no true statistics on top how many acid attacks dey happun for Nigeria, di Acid Survivors Trust International, dia be 1500 recorded attacks for world.

Even with dis number, 60% of di amount of attacks wey dey happun no go dey reported.

ASTI say 80% of di attacks wey involve acid dey directed to women and girls.

Dem tok for inside report say most developing kontris no get neta national system wey go monitor burn victims.

Dem say many of di kontris wey acid attacks dey happun na because dem get high amounts of violence afainst women.

Di Advocates for Human Rights for dia project on Stop Violence Against Women bin note say, "Acid violence dey common mostly because e no cost and e dey readily available. Motives for dis kain attacks dey differnet from kontri to kontri.

"For developing kontris, acid attacks dey normally seen as crimes of passion wey men dey commit against women afta refusal of marriage proposals, if di woman dey cheat, or woman no gree knack and sake of disagreements about bride price."