Seyi Tinubu react to NANS factional president allegations say e attempt to bribe and assault am

Nigeria President Seyi Tinubu

Wia dis foto come from, Seyi Tinubu/Instagram

Read am in 3 mins

Nigeria President son, Seyi Tinubu don respond to one tori wey dey spread say e send thugs to attack one factional President of di National Association of Nigerian Students (NANS), Atiku Isah.

Di president son wey debunk di accuse for im Instagram story on Friday, 2 May tok say na attempt to defame im character.

"Wow.. how pesin go fit lie wit so much confidence. Dis na attempt to defame my character. May God be with you, Comrade Atiku Isah."

E also say im neva ever meet wit Oga Isah.

"I no ever hold meeting to discuss any subject matter wit Comrade Isah for Lagos or for anywhere in di world. I neva meet am bifor. I no ever visit any location wit thugs. All dis allegations by Isah na false, no be true."

Im reaction dey come afta di factional president accuse Seyi Tinubu of bribery, abduction, assault, among odas.

Seyi Tinubu Instagram story screen shot

Wia dis foto come from, Seyi Tinubu/X

Di NANS factional president for one recent press conference bin tok how di presido son allegedly send thugs to scata di inauguration event of di association wey hold recently for Abuja, di kontri capital.

E also claim say di president son bin try bribe am wit one hundred million naira to promote di president wey im reject.

E allege say sake of im refusal to collect bribe, hoodlums abduct am on 15 April, strip am naked and attack am.

For di video of di press conference wey dey circulate for social media, Oga Isah allege say:

"Dem invite me to Lagos to meet wit Seyi. I meet wit Seyi and di Minister for Youth. Di minister wen e see me hug me and we tok, and dem wan offer me one hundred million naira, but di tin no be all about money. E get tins wey I stand for. You no fit ask me to begin promote a president wey neva do anytin for me to say e don do am. If e do anytin wey good, we go promote and support am, but wia e do something wey go wrong, you no fit say make we keep quiet, dat one we no go do.

Dem kidnap me on di 15th of April. Dem strip me naked and seriously beat me. Dem threaten to release a video.

Dem threaten say notin go happun if dem release di video, and even if dem kill me, Seyi Tinubu go order a cover-up." E tok for di video.

E also allege say dem torture am and force am to resign from im position.

Fotos of di alleged attack also dey spread on social media, but BBC Pidgin neva fit authenticate am.