How Ghana immigration arrest 93 Nigerians ova alleged internet fraud and oda crimes

Authorities are clamping down on foreigners who engage in all sorts of crimes in Ghana

Wia dis foto come from, GHANA IMMIGRATION SERVICE

Wetin we call dis foto, Di immigration service say dem seize fake dollar notes, fake golf bars, 82 laptops among odas for dis operation
Read am in 5 mins

Di Ghana Immigration Service say dem arrest 93 Nigerians allegedly involved for fraud and oda immigration wahala.

91 of di suspects be males wit two females.

Di Ghana Immigration Service tok inside one statement say dem carry out di intelligence operation to capture di suspects wey be notorious for fraud.

"Dis operation bin target six houses for Devtraco Estate wey dem rescue 73 victims wey don suffer torture and abuse from di suspects," Maud Anima Quainoo tok inside dia statement.

For dis operation, dem seize fake dollar notes, fake golf bars, 82 laptops among odas.

many cases involving foreigners continue to linger in the courts for many years

Wia dis foto come from, GHANA IMMIGRATION SERVICE

Wetin we call dis foto, Authorities dem already repatriate di 73 rescued victims to Nigeria

Di immigration service don add say dem find "57 mobile phone, 17 TVs and oda tins for di operation.

According di service, Investigation don reveal say some of di suspects bin enta Ghana through unapproved routes wey odas overstay dia 90-day visa-free entry.

"Di service don already repatriate di 73 rescued victims to Nigeria."

Dis no be di first time authorities bin dey crackdown on foreigners wey dey allegedly involve for fraud and oda crimes for di kontri.

Di service togeda wit di police go put di suspects bifor court to face di law.

But dem also dey wran say all foreigners gatz to comply wit di laws of Ghana.

Di human trafficking act, 2005 (Act 694) dey against recruitment, transportation or keeping pipo by force, fraud or abuse for exploitation.

Pesin wey dey guilty for dis kind tin fit enta jail for between 5-20 years or even life imprisonment and fines.

Di immigration service also tok say to dey enta di kontri from unapproved routes or to overstay visa, be criminal offence.

Oda times Ghana authorities pursue 'cyber criminals'

Di latest arrest be part of plans to deal wit wetin authorities describe as crime wey involve foreigners.

16 January 2026 – di Ghana police collaborate wit di police and cyber security authority and immigration to arrest 53 Nigerians wey allegedly dey involve for cybercrime wey dem rescue 44 odas wey be suspected victims of forced labour.

27 December 2025 – Di immigration, police and cyber security authority arrest a total of 141 suspects for Tabora and Lashibi.

Dem collect 38 laptops, 150 mobile phones wey authorities believe say dem use to commit financial crimes.

Di authorities also arrest di landlord of di house wia di 100 pipo dey stay. Di suspects dey accused of mobile money fraud, romance scam, sextortion and wire fraud. Di suspects dey for police custody wey dem dey assist for investigation.

24 December 2025 - Dem arrest 48 suspects for Dawhenya for di Greater Accra region – 46 males and two females wey be Nigerians linked to cybercrimes like online investment fraud, impersonation and illegal gold trading among odas. During dat operation, dem say dem seize 54 laptops, 39 mobile phones, star link internet device and oda routers.

13 December 2025 – Di cyber security authority arrest 32 suspects for one operation for Kasoa – Tuba. All di suspects be Nigerian nationals, wia dem seize 31 laptops, 15 mobile phones among odas.

11 December 2025 – Authorities combine to arrest Frederick Kumi aka Abu Trica and two odas for dia role in romance scams wey allegedly defraud US pipo up to $8m.

Dis arrest follow indictment by grand jury for di US wey tok say Abu Trica and di oda suspects use AI to fake identity of oda pipo wey dem scam Americans.

Dem charge Abu Trica wit conspiracy to commit wire fraud, money laundering among odas, wey Ghana authorities dey work to extradite am to di US to face trial. Dat process still dey underway.

the immigration service has been increasing border activity

Wia dis foto come from, GHANA IMMIGRATION SERVICE

Wetin we call dis foto, To enta Ghana through unapproved routes be illegal wey to also carry pipo enta di kontri to do hard labour be crime

On 30 April, 2025, di circuit court for Achimota sentence two pipo for trafficking two ladies from Nigeria to Ghana to engage for prostitution. Jessica Daniel aka Blessing and Kelvin Johnson aka Alaska lure di victims to enta Ghana say dem go give dem job as domestic servants but las las dem end up for prostitution.

On 29 May 2025, di court jail Nigerian Promise Ebuorbo and four accomplices say dem keep illegal migrants for dia house wey dem involve for cybercrime wey dem dey scam real estate pipo. Promise Ebuorbo chop 12-month prison sentence wit fine.

For 30 July 2025, di district court for Ashaiman jail two Nigerians for 18 months wit hard labour sake of cyber fraud and illegal entry into di kontri. John Moore and Charles Bruce plead guilty to di charge of engaging for Yahoo-Yahoo and entering Ghana by unapproved border.