Senate ask NSA to chook eye as tori spread say Akpabio dey hospital for London

Godswill Akpabio wear sky blue cloth wit Navy blue cap and eyeglasses as e stand for red podium wit three different branded microphones.

Wia dis foto come from, Godswill Akpabio Facebook

Wetin we call dis foto, Nigeria Senate President, Godswill Akpabio
Read am in 3 mins

President of di Nigeria Senate, Godswill Akpabio sit down for im chair as e lead plenary on Tuesday for di National Assembly.

Wetin suppose to be im daily routine raise tok-tok sake of rumour wey bin dey fly upandan say di Senator dey sick and im dey for one London hospital.

Pipo begin search online sotay 'Akpabio hospitalised' trend from Monday till Tuesday.

Dis rumour plus odas wey bin don hapun make Senator Titus Zam para for plenary on Tuesday as e raise point of order under order 42.

E wan make dem chook eye for wetin dey make dis rumours to spread for social media.

Na why di Nigeria Senate direct di National Security Adviser, Nuhu Ribadu, to investigate widespread rumors ontop social media wey dey allege say Senate President Godswill AKpabio collapse.

Dis no be di first time tori dey spread about di Senate President Godswill Akpabio health.

For plenary, Senator Zam say di rumours no dey acceptable and e dey shock dem to hear dis kain tok wey dey fly upandan.

Im say di Senate president na di third pesin for Nigeria and any mata wey concern am no suppose to fly to di extent wey e go dey misinform pipo.

Oga Akpabio wey agree say e dey hard to control wetin pipo dey tok for social media add say dem no go fit stop pipo make dem no write wetin im describe as 'garbage in, garbage out'.

E, however, ask weda na di wish of di Senate say make dem refer to di National Security Adviser, NSA, for investigation.

Senators support di proposal say make di NSA chook eye for di pipo wey dey spread rumour about di Senate president wit voice votes.

Dem aslo adopt am, as dem agree say make di NSA investigate who dey start dis rumours, wetin dem wan achieve from dis rumours wey dey allege say Senate President collapse.

Rumours and fake news no dey new for Nigeria, e dey affect mostly politicians and celebrities and oda pipo wey dey for public eye.

Recently fake tori bin fly say former Nigeria Head of State, Gen. Yakubu Gowon die, e waka sotay some pipo for social media bin send condolence and RIP message for dia page,.

Anoda one wey trend na di one of former Anambra State govnor, Willie Obiano.

Fake tori bin spread say im die.

Rumours about di death of former president, Muhammadu Buhari bin fly well-well before e finally die for 2025.

Some pipo bin dey argue say na 'cloned' president bin dey rule Nigeria. Even wen im die, some pipo still no believe sake of say for dia eyes, im bin don die bifor.