Gold price dey go up but na wise investment for times of financial wahala?

    • Author, Debula Kemoli
    • Role, BBC World Service
  • Read am in 4 mins

Di price of gold all ova di world don rise, as e pass a record high of more dan $4,400 an ounce.

Di price rise, as expectations dey say di US central bank go further cut interest rates next year, according to analysts.

Gold bin start di year worth $2,600 for one ounce but geopolitical tensions plus tariffs wey US President Donald Trump impose, and expectations of rate cuts don fuel investors demand for "safe haven" assets.

If dem reduce di interest rate, cash go lose im real value, wey go make gold to be more attractive investment.

Di prices of oda precious metals, like silver and platinum, don also rise.

Di precious metal dey traditionally seen as a reliable, tangible asset for times of financial difficulty or instability.

Di price of silver also hit a record of $69.44 for one ounce on Monday.

For 2025 so far, silver go up to 138% year-to-date and platinum dey at a 17 year high.

Wen financial markets fall, sudden "gold rush" fit dey wia large number of buyers – wey include govments and individual investors – go try to buy di precious metal, Dr Philip Fliers, one economic historian from di University of Belfast tok.

No be evribody wey dey invest for gold dey buy di physical precious metal.

Some investors dey put dia money into financial products like exchange-traded funds (ETFs), wey dey backed by gold.

Dis year, gold ETFs break record as pipo so far don invest $77bn, according to di World Gold Council trade association.

"Gold na 'safe' investment but dat no mean say e no get im own risk," Dr Fliers tok.

For January 2020, as di Covid-19 outbreak start, di price of gold go up, but by March dat same year, e begin drop.

"Wen confidence in financial assets and policy stability start to shake, gold dey tend to respond first as di primary monetary metal," Anita Wright, chartered financial planner for Ribble Wealth Management tok.

Gold get reputation to be investment pipo fit turn to in times economic uncertainty, no be only because of im value, but also across history and different cultures, e get high value and pipo fit easily trade am.

From di Gold Mask of Tutankhamun from Ancient Egypt to di Golden Stool of di Asante for Ghana and di Gold Thrones of Padmanabhaswamy Temple for India, di metal historically hold religious and symbolic importance.

No be surprise say many pipo dey see gold as a reliable way to store dia wealth.

Di value of gold items and jewellery for house most times no dey, dey affected by di shifts of di global financial markets.

But any large investments fit dey at di mercy of di actions of big financial players.

"A lot of dis," Dr Fliers, as e dey refer to di recent rises in gold prices tok say, "I suspect say govment central banks dey buy up gold and na wetin dey drive di high prices".

Dem often dey buy plenty gold to boost dia reserves as dem shift away from equity investments in times of uncertainty.

Dis one mean say investing in di previous metal fit dey dangerous.

"Na still risky strategy to speculate on gold increasing bicos as soon as markets calm down, and govments come to dia senses, pipo go leave gold again," Dr Fliers tok.

"I go say tins like investing in gold, do am for di long run."