Wetin we sabi so far about di militant attack for Turkey Aerospace company

Wia dis foto come from, CCTV image
Turkey minister of interior minister don comfam say five pipo na im dem kill and 14 pipo injure for attack inside Turkish aerospace company near Ankara.
For im post for X, Ali Yerlikaya say security forces don kill di two suspects for di attack.
Ali Yerlikaya call di incident outside Turkish Aerospace Industries (TAI) "terrorist attack", as im add say "unfortunately, we get martyrs and injured pipo"
CCTV images from inside di aviation facility show wetin be like man wey carry weapon.
Di videos show two attackers wey carry rucksacks plus dey heavily armed, as dem stop for di gates of di facility inside wetin resemble yellow taxi.
Dem immediately open fire on pipo wey dey waka dia own outside di gates, before de menta di building.
Di Ankara chief public prosecutor office don start one judicial investigation into di attack, according to Yılmaz Tunç, Turkey justice minister.
For im post for X im mention say one deputy chief public prosecutor and eight public prosecutors na im dem don assign to di case.
So far authorities never give enough details of wetin dey happun and how many pipo fit dey involve.
Local tori pipo bin report one blast and shooting outside di site wey dey about 40km (25 miles) outside Ankara.
Di place wey dey under attack na di headquarters of TAI for Kahramankazan, around 17 miles (28km) for north west of Ankara.
According to di aerospace company website, di campus covers area wey reach about 1.5 square miles (4 sq km).
E never clear exactly wia and wetin dem attack for di very big site.

Wia dis foto come from, Getty Images
What we know so far
- Four pipo reportedly dead, with 14 wounded, officials tok
- Two suspects - one man and one woman - don dey "neutralised," Turkey interior minister tok
Wetin we no know yet
- Who dey behind di attack
- Exactly how many attackers dey involved
Key question about which group fit dey behind dis attack
Turkey no be stranger to attacks wey dem dey call terrorism.
Historically, di kontri dey mostly blame am on di Kurdish separatists, wey dia camp dey for northern Syria plus oda places for di region don come under repeat airstrikes from Turkish air force.
But di Islamic State group (IS) also dey present for Turkey.
In addition to dis, di question dey about di Turkish aerospace industry wey dey produce drones wey don change di whole war between Armenia and Azerbaijan.
For di early stages of Russia invasion of Ukraine, Ukraine make serious use of Turkish Bayraktar drones to target Russia tanks before Ukraine begin mass produce im own drones.
So di main question now, as di investigation into dis attack dey go on, na who e go pay pass from wetin happun and why?
Dis attack dey happun as authorities dey debate about weda to resume peace tok wit Kurdish militant group PKK.
PKK na one Kurdish militant group, wey di Turkey, the US and UK goment ban as terrorist organisation.
E dey also come one day afta one friend to di goment Devlet Bahceli say make PKK leader Abdullah Ocalan announce say dem don "abolition" di group for parliament, as dis go suggest im release from prison.
Bahceli na one of di main player for Turkish politics, and dem dey consider suggestion wella sake of im opposition to former peace tok.
PKK don dey fight insurgency against Turkish goment to get greater rights for di kontri significant Kurdish minority since 1980s.
No group don claim responsibility for di attack.
World leaders condemn attack
Turkish president Recep Tayyip Erdogan wey just land Kazan for Russia today for di BRICS summit don condemn di attack.
Leaders of some oda kontris also don join condemn di TAI attack.
Russia President Vladimir Putin condemn di attack as im bin dey speak for di BRICS event, according to Reuters news agency.
Germany foreign ministry say im “condemn all form of terrorism in di strongest possible terms,” come add say im "solidarity dey go out to our Turkish friends".
For post wey dem make for X, dem say dia embassy for Ankara plus dia response centre for Berlin dey torchlight wetin dey happun very closely.
US embassy for Turkey also post for X, greet di families of pipo wey don die or innjre for dis attack.
Greece ministry of foreign affairs say make pipo totally condemn di attack, come greet all di family of di victims.
Meanwhile, UK embassy for Turkey say im "stand in solidarity" wit im ally.
Nato secretary general, Mark Rutte, post for X, say report on di attack dey "deeply concerning," come add say dem too dey closely monitor di development
Wetin be Turkish Aerospace Industries?
Turkish Aerospace Industries arms and aerospace technology company wey belong to di goment. E base near di kontri capital Ankara.
Di company dey produce both military and civilian planes and helicopters, plus drone systems for di Turkish armed forces and odas across di world.
Turkey launch TAI, according to im website, to reduce Turkey reliance on foreign import of aerospace technology wey military dey use.
Na di company wey di Nato member give authority to manufacture US-designed F-16 fighter jets.
TAI also get hand for di modernising of older aircraft wey Turkish military fit use.
Di two principle owners na Turkish Armed Forces and one civilian arm of Turkey goment wey dey in charge of improving im defence capabilities and managing military procurement.










