Eight wound afta man set pipo on fire for Colorado rally for Israeli hostages
Eight pipo don wunjure afte one man throw fire bomb wia pipo gada for Boulder, Colorado.
Di pipo bin gather to demonstrate in remembrance of di Israeli hostages wey still dey for Gaza, authorities tok.
But one 45-year-old man wey shout 'Free Palestine' just throw fire bomb inside di gathering. Dem don identify di man as Mohamed Soliman from Egypt.
Boulder Police Chief Stephen Redfearn say many pipo wunjure for di incident, including injuries like burns and odas.
Redfearn say police find di suspect and take am to custody "without incident" – dem also carry di suspect go hospital wit minor injuries, di police chief tok.
Israel foreign minister, Gideon Sa'ar, for im statement say e dey "shocked" by di incident and call di attack "pure antisemitism".
"Shocked by di terrible antisemitic terror attack targeting Jews for Boulder, Colorado," e write on X.
"Dis na pure Antisemitism, fueled by di blood libels wey dey spread for media. I tok wit our Ambassador for di US and our Consul General for LA."
Homeland Security Secretary Kristi Noem say di her department dey work wit "interagency partners, including di FBI", on di mata.
Di FBI for press conference say dem dey treat di attack as a suspected act of terrorism.

Wia dis foto come from, Reuters
Footage wey appear from di attack show a scene of smoke wey fill di air, pipo running to multiple directions, spots of grass on fire and pipo wey wunjure for di ground.
From images and videos wey dem post online, but BBC neva verify yet, a man wey appear to be di suspect dey witout a shirt and holding bottles wit liquid wit a piece of red cloth inside.
E dey shout at di crowd and appear to dey move towards di crowd as some of dem rush to run comot.
As e scream, one woman dey on di ground and appear say e wunjure. Pipo surround her and one man pour water on her bodi.
Footage show police dey rush to di scene and arrest di suspect. Police say dem take am go hospital wit injuries.
"E dey clear say na target act of violence and di FBI dey investigate dis as an act of terrorism," Mr Michalek tok. "Sadly, attacks like dis dey become too common across di kontri."
Di attack na di second high-profile act of violence for di US for di last two weeks related to di conflict in Gaza.
Who be di suspect?
Di suspect dey named as Mohamed Sabry Soliman, wey dem take to hospital shortly afta di attack.
Boulder Police Chief Stephen Redfearn say e no believe anyone else dey involved. "We dey fairly confident we get di lone suspect for custody," e say.
Di 45-year-old na an Egyptian national, govment officials confam to di BBC broadcast partner, CBS for Colorado.
In 2022, Soliman enta California on a non-immigrant visa wey expire in February 2023, multiple sources don tell CBS News. E neva tey wey e begin live for Colorado Springs.
According to di FBI, di suspect shout "free Palestine" as e carry out di attack as e use a "makeshift flamethrower" and a "fire bomb device".
Who be di victims?
E get eight victims, wey dey age between 52 and 88. Four na woman and four na men. All of dem don go di hospitals wit burns and oda injuries. Di injuries range from "minor" to "veri serious".
At least one of di victims dey seriously injured.











