Iran launch revenge attack missiles on Israel, as Supreme Leader vow to 'wreak heavy blow'

Iran Launches Ballistic Missiles at Israel

Wia dis foto come from, Reuters

Read am in 3 mins

Israeli military say Iran don launch missiles towards Israel on Friday, 13 June, but dia defence systems dey work to stop di threat.

Dis attack dey come in retaliation for Israel overnight attack on Iran.

For one statement, Israeli military say dem don tell kontri pipo to hide for shelter until further noticed.

Huge smoke bin rise above Tel Aviv for Israel, around skyscrapers for di city.

Di smoke cover di tall buildings around am.

E neva clear if di burning na from di missiles, or di interceptions.

Iran Supreme Leader Ali Khamenei don tok say Iran "go inflict heavy blows" afta Israel "launch war".

E warn say Iranian forces go "act wit strength" against Israel.

Di Supreme leader bin post on X, say dem no "go escape unscathed from dis crime".

"Di Iranian nation fit dey assured say shortcomings no go dey in dis regard."

However, di Islamic Revolutionary Guard, don confam say na dem carry out di attacks against "dozens of targets, military centres and airbases" for Israel.

According to di translated statement, Iran call di operation "True Promise 3".

Di statement add say dem go give details of di operation in a later announcement.

Meanwhile, Israel national ambulance service, Magen David Adom, tok say five pipo injure for di Tel Aviv metropolitan area from di attack and dem don carry dem go hospital.

One dey for "moderate condition" and di oda four get "lightly injury" by shrapnel, Oga Adom tok.

For one statement, Israeli PM Benjamin Netanyahu post on 'Operation Rising Lion' immediately afta Iran launch di attack, e say di objective of im kontri recent attacks on Iran na to "stop Islamic regime nuclear and ballistic missile threat to us".

UK Foreign Minister urge iranian counterpart make e remain 'calm'

David Lammy tok say e don tok to Iranian counterpart to dey calm afta Israel launch series of strikes against Iran, wetin Lammy describe as "unilateral act".

"I speak to my Iranian counterpart today to urge restraint at dis time, and calm. I recognise say dis na time of danger for Middle East," e tell Sky News.

"We dey advise against travel to Israel at dis time."

Fotos from Tel Aviv

Di foto appear like say Israeli missile defence system - di Iron Dome - dey try intercept di ballistic missiles Iran fire.

Wia dis foto come from, Reuters

Di foto appear like say Israeli missile defence system - di Iron Dome - dey try intercept di ballistic missiles Iran fire.

Wia dis foto come from, Reuters

Di foto appear like say Israeli missile defence system - di Iron Dome - dey try intercept di ballistic missiles Iran fire.

Wia dis foto come from, Anadolu via Getty Images