Wetin Davido tok wey dey make Nigerians para for am

Wia dis foto come from, Getty Images
Grammy-nominee Davido dey under fire over im comment about di situation for Nigeria.
Di Afrobeats star wey im real name na David Adeleke for one podcast bin dey tok generally about Nigeria economic situation.
Davido na one of di artistes wey dey use im music and influence promote Nigeria – but im latest comment about di kontri dey cause mixed reactions.
For di Big Homies House podcast, Davido respond to question wia dem ask am if pipo fit leave America go Africa afta Trump win, e tok say, "leave America, go wia?"
E add say, "make we dey honest, go back wia? E no dey cool back home".
Di Awuke singer explain say, "di economy now dey in shambles. Di situation for di kontri, we Nigerians sabi say di exchage rate dey messed up."
"A lot of tins no dey go on well. The oil prices dey too high, imagine say as we dey produce oil, and we dey pay more money for oil dan kontri wey dey import am... We no get beta leaders dat one na fact."
Davido desccribe imsef as ambassador wey no go dey show di bad situation wey dey happun for di kontri sake of say na ambassador wey e be.
But e add say, "entertainment na one of di tins wey dey make Africa look good."
Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of Instagram post
Many pipo don respond to di video clip wey drop for social media on 20 November including high profile pipo wey no like wetin e tok.
One supporter of di ruling party for Nigeria All Progressives Congress Joe Igbokwe tok for im facebook page say, "speak good about youur kontri and progress hia. If you no like your kontri, no need to mock am or run her down. Just check out and move to different kontri".
Actor Patrick Doyle write for im Facebook page say, "you gatz be dummy to ask foreigners make dem no come kontri wey your papa get $2 billion dollar power generation investment. Some pipo suppose know beta" as e add Davido picture to di post.
Oda Nigerians chook mouth to point out say even as e dey tok say Nigeria no get beta leaders, im uncle dey among Nigerian leaders.
Davido na di nephew of Osun state govnor, Ademola Adeleke.
Meanwhile, more and more pipo dey comot to stand behind Davido statement say wetin e tok no be lie.
Rapper Ruggedman na di first to speak out for am say, "Davido tok wetin im tok, di solution na to fix Nigeria so nobodi go fit tok dat kain tin again. All dis tok no dey fix di kontri. Hardship dey too much."
Also media personality, Charly Boy wey say, "Make una leave Davio alone, e tok am as e see am."
Meanwhile Davido by imself don speak out on all di gbas-gbos wey dey go on for social media.
E reveal say some pipo wan cancel im show as well as lament di way nobodi catch im oda interview wia im bin comment say, anytin wey im win or buy e dey take am go house bicos na im fans or house put money inside im pocket, im hala for X say, "dem no go see dis one".










