Who be di most wanted Ansaru terrorist group leaders wey Nigeria security forces gbab

Read am in 3 mins

Di National Security Adviser, Nuhu Ribadu, don announce say di Nigeria security forces gbab two top Ansaru terrorist group leaders wey e identify as Abu Baraa, di Amir, and Mahmuda, di deputy Amir.

Ribadu yarn dis one for press briefing on security developments for di Office of di National Security Adviser.

Di NSA say na dis two men dey responsible for planning several terrorist operations for Nigeria and high-profile kidnappings.

According to Ribadu, Mahmud Muhammad Usman (aka Abu Baraa/Abbas/Mukhtar), na self-styled emir of Ansaru.

"Na im be di coordinator of various terrorist sleeper cells across Nigeria. Na im also be di mastermind of several high-profile kidnappings and armed robberies wey dem dey use to finance terrorism ova di years.

Ribadu say Mahmud al-Nigeri (aka Mallam Mamuda) na Abu Baraa proclaimed Chief of Staff and Deputy.

Di NSA say Mamuda na di leader of "Mahmudawa" cell wey dey around di Kainji National Park, between Niger and Kwara states, up to di Benin Republic.

"Mamuda bin train for Libya between 2013 and 2015 under foreign jihadist instructors from Egypt, Tunisia, and Algeria, and specialise in weapons handling and IED fabrication," e tok.

According to di NSA di two men don dey ontop Nigeria most wanted list for years, afta dem jointly lead multiple attacks on civilians, security forces, and critical infrastructure.

Ribadu say some of di operations of di suspects include:

  • Di 2022 Kuje jailbreak.
  • Di attack on di Niger uranium facility.
  • Kidnapping of one French Engineer, Francis Collomp for Katsina.
  • Kidnapping of Alhaji Musa Umar Uba (Magajin Garin Daura) wey bin happun on 1 May, 2019.

Oga Ribadu add say "na dem bin also dey behind di abduction of di Emir of Wawa, and dem dey maintain active links wit terrorist groups across di Maghreb, particularly for Mali, Niger, and Burkina Faso. Di two men, wey dey wanted internationally, currently dey custody.

"Di capture of Abu Baraa and Mallam Mamuda, wey be di group leader and deputy commander, mark one of di most significant achievements to date for our ongoing effort to rid Nigeria of di threat of terrorism. Di successful capture of di leadership of dis dangerous business mark di most decisive blow against Ansaru since dem start."

Di National Security Adviser say di arrests don "effectively dismantle" di central command of di group as e dey open road to finish dem kpatakpata.

Tori be say di Ansaru group bin first show face for January 2012, wit a public declaration for Kano, as one faction from Boko Haram, wey position e sef as "humane alternative".

But e no waste time bifor dia aim change sharp-sharp to begin attack Nigerian security operatives, civilian communities, and goment property.

Ribadu explain further say di group bin publicly display di setting sun logo of Al-Qaeda for di Islamic Maghreb (AQIM), wey signal di ideological and operational alignment wit global jihadist movement.

According to di NSA, Ansaru keep dia sef for many years, for both sleeper cells wey dey for city and forest enclaves across several cities for northern Nigeria and forest-based enclaves, particularly around Kainji National Park, wey dey operate for Niger and Kwara states, and Benin Republic.