'How new terrorist group for north-west Nigeria take emerge' - Nigerian military

Read am in 3 mins

Di Defence Headquarters don confam say one new terrorist group known as Lukarawas don dey for di north-western part of di kontri.

Di Director of Defence Media Operations, Maj. Gen. Edward Buba, tok dis one wen e brief tori pipo on military operations on Thursday for Abuja.

E tok say di new terror group come from Republic of Niger afta di recent coup wey disrupt military cooperation between Nigeria and Niger.

According to Buba, di terrorists from di Niger Republic and Mali begin infiltrate di northern areas of Sokoto and Kebbi States afta di coup for Niger.

E add say bifor di coup, joint border operations bin dey wit between di Nigerien security forces and di Nigerian security forces wey keep di terrorists at a distance. But wen breakdown of cooperation bin dey between di two kontris, di terrorist group bin take advantage of am.

“Di terrorists bin take advantage of di gaps for cooperation between both kontris and exploit difficult terrains to enta remote areas for some north-western states to spread dia ideology," Buba tok.

Locals welcome di terrorists to dia midst - DHQ

On how di terrorists take enta di north-western states, di military say wen dem come in, di locals know say dem don get strangers for dia midst and dem welcome dem.

“Di locals initially welcome di terrorists wey dem believe say get good intentions, and dem fail to report di movement give di military and security agencies."

E explain say di locals allow dem settle in and dem begin spread dia ideology. Afta dem settle in, gain foothold and sabi di area well-well, dem begin impose some levies on di pipo, dat na wen dia eyes clear and dem notify di authorities.

Di DHQ tok-tok pesin say dem no wia dis new terror group dey and give assurance say Nigerian troops get sustained intelligence, Surveillance, and Reconnaissance (ISR) to clear di terrorists.

E add say di terror group don continue to take advantage of di vast under-governed areas to hide and avoid troops plus harass di locals.

According to am, troops dey locate dem and dem dey eliminate di threat.

Lukarawas join oda terror groups, wey kontri pipo dey call bandits, wey dey operate for north-west Nigeria.

Di terror groups dey attack communities and travellers at will. Dem dey kill and kidnap victims and also demand ransom.