Wetin di re-opening of US govment mean for the world?

Wia dis foto come from, Win McNamee/Getty Images
Di US Mission don announce say dem dey start full operatios of di US Embassy and Consulate for Nigeria.
Dis dey come afta di Republican controlled House for di US on Wednesday approve new funding bill wit vote of 222 to 209 as six Democrats join Republicans to say yes, bifor President Donald Trump sign di bill to law hours later.
Di shutdown wey reach 43 days na one of di longest in America history.
E bin affect many tins for di kontri wey include di money wey dem dey use feed pipo wey no too get for di kontri, dat tin wey dem dey call SNAP benefits.
But e bin affect di world?
International travels
Part of di tins wey di goment shutdown bin affect na di air traffic workers wey bin dey work witout pay.
But many of dem say dem no well so many flights don dey cancelled for airports around di kontri.
Even sef, di federal goment place mandate wey limit cuts for di amount of flights for airlines to free air controllers small, make dem fit dem still dey arrange tins to dey go smoothly.
Consular Operations home and away
Passports dey di hand of Department of State wey dey make sure say, di "consular operations domestically and abroad go continue dey work".
Dis consular operations mean tins like passports, visas and to help US citizens wey dey abroad.
Howeva for di beginning of di shudown for 1 October, di US Mission for Nigeria send informate say dem no go dey post regilar updates for dia social media except na urgent safety and securty informate.
Even though dem no tok say e go affect anytin, on Friday dem confam say, di embassy and consulate don start full operations ontop di "end of lapse of appropraitions."
Price of Gold

Wia dis foto come from, Matt Jelonek/Bloomberg via Getty Images
For October, di price of gold bin reach record high of ova $4,000 (£2,985) per ounce.
Dis na as investors start to dey find safe place to put money ova worry sake of di economic and political uncertainty for world.
Howeva analysts call anoda reason for di biggest rally around gold since di 1970s, say investors dey worry ova di release of key economic data as di US goment shutdown bin dey go on.
Christoher Wong wey be OCBC rates strategists tok say di US goment shutdown na "tailwind for gold prices".
Di price of gold climb up by almost 4% wen goment shutdown for Trump first term for di White House.
Wetin cause di US goment shutdown
US goment shut down for di first time in almost seven years afta members of Congress no gree on one last minute funding deal.
Di Senate need sixty votes to pass govment funding bill, dis one mean say even though na di Republicans dey control both chambers of Congress, dem go need Democratic backing to reopen govment.
One short-term Republican spending plan bin fail to win enough support on Tuesday, and dem also vote down one Democrat-led proposal.
Senators vote 55-45 in favour of di Republican-led bill, wey for keep di govment funding for di current levels e dey temporarily.
Di two sides don dey tackle each oda for some time now on top healthcare spending, as Democrats argue say any funding bill must include extension to health insurance subsidies wey go expire for di end of di year.
Many Republicans say di subsidies too cost, while odas bin propose introducing stricter eligibility rules bifor extending dem.
Earlier, di top Senate Democrat Chuck Schumer bin tok say Republicans dey try "bully" Democrats by refusing to negotiate on healthcare.
Shutdowns over budgets dey almost unique to US politics.
Under di US system, di different branches of govments gatz reach agreement on spending plans bifor dem fit become law.
For most kontris, budget votes dey become votes of confidence for di govments demsefs. But bicos US get equal and often divided branches of govment, dat no be di case.








