Why US place $25,000 reward on Nigerian over alleged murder of im three-month-old son

Foto of Olalekan Olawusi

Wia dis foto come from, Getty Images/United States Marshals Service

Read am in 3 mins

United States Marshals don add one Nigeria man for di kontri "15 Most Wanted" list plus sama $25,000 reward for anybody wey sabi how to arrest am, afta im allegedly kill im son.

Inside one statement wey BBC see, di security agency say Olalekan Abimbola Olawusi, dey wanted for charge of murder and inflicting bodily injury to small one small pikin for Rhode Island.

Im dey also face charge as fugitive wey run away to avoid facing trial for court.

Olawusi, 48, dey face charge of first-degree murder plus two counts of inflicting serious bodily injury to small pikin, afta Providence Police and Fire fighters find im three-month-old son dey bleed for mouth and nose for im house for April 3, 2017.

Dem say di pikin bin already enta cardiac arrest as dem transport am, so dem gatz to revive am.

Exam wey dem do for hospital show say di three-month-old pikin bin get 18 different injuries wey dey different stages of healing. Sometin wey show say im don dey beat plus abuse di pikin for long time.

Di injury include crack for skull, blood cloth inside brain, significant brain injury, and crack for di pikin rib, shoulder, legs and arms.

Dem put am for life support, but im die die six months later.

Director Ronald L. Davis of U.S. Marshals Service say: “We don place Oga Olawusi on our 15 Most Wanted list sake of di wicked crimes wey im don commit and di threat wey im kontinu to cause di public.”

Providence police bin arrest plus charge Olawusi on April 20, 2017, wit first-degree child abuse.

Dem later release am di same day, and im later vamoos.

Di police later add di charge for alleged murder afta di pikin die on 31 October 2017.

Investigate show say Olawusi bin use im Nigeria passport fly out of John F. Kennedy International Airport, New York on June 20, 2017.

US Marshal believe say na im family members for Nigeria help am disappear, and dem add say im fit be danger to oda children.

Dem first create di US Marshal 15 Most Wanted list for 1983 to draw attention to some of di kontri most dangerous pus high-profile fugitives or runaway criminals.

Pipo wey dia names enta di 15 Most Wanted list na pipo wey authorities for US consider to be di “worst of di worst” and dem fit include murderers like, sex offenders, major drug lord, organized crime figures and pipo wey dem dey find for high-profile financial crimes.