Burkina Faso no gree take deportees, America stop to dey issue visa for di country

One Honduran immigration detainee, wey dem bind im legs and shoes lace as security precaution, dey board one deportation flight go Honduras

Wia dis foto come from, Getty Images

    • Author, André Rhoden-Paul
  • Read am in 3 mins

Burkina Faso military govment no gree collect deportees from di US.

Dis dey come as Washington suspend to dey issue visa to di West African nation.

Di country Minister of Foreign Affairs Karamoko Jean-Marie Traoré bin question if di embassy decision na "blackmail" afta e tok say dem bin reject American proposal to collect migrants from third countries.

Donald Trump administration don turn to African countries as location wia e go deport migrants go as part of im crackdown on immigration.

BBC don contact US State Department and Department of Homeland Security for comment.

Burkina Faso leader Capt Ibrahim Traoré style imsef as a pan-African champion, wey dey stand up to Western imperialism.

Im military govment bin seize power inside one coup three years ago, and e no get good relationship wit Western nations since dat time.

Di foreign minister wey appear on state broadcaster RTB late on Thursday bin ask: "Shey dis na way to pressure us? Na blackmail be dis? Anytin e like make e be... Burkina Faso na place of dignity, na destination, no be place of expulsion."

E say im bin get meeting wit di US Embassy on Wednesday, and im reject dia offer for dia – wia dem don tok repeatedly say make dem accept deportees.

On Thursday, 9 October, di US embassy for Burkina Faso capital Ouagadougou bin tok on dia website say dem go temporarily pause to dey issue immigrant, tourist, student and business travellers, wey go become effective from Friday, 10 October.

"U.S. Embassy Ouagadougou don temporarily pause all routine visa services effective October 10, 2025. Dis pause include immigrant visas and non-immigrant visas for tourists, business travellers, students, exchange visitors, and most oda non-immigrant categories," di statement tok.

Instead, residents of Burkina Faso go need travel go di US embassy in di capital of neighbouring Togo, Lome to conduct any visa services.

Karamoko Jean-Marie Traoré tok say im bin receive one diplomatic note from di US wey explain say dem don put Burkina Faso on list of countries wey dia citizens no respect rules around US visas and dem refer to di US proposals, according to one local news outlet transcript of di interview.

Several African kontris – wey include Eswatini, Ghana, Rwanda and South Sudan – all of dem don accept pipo from third wey countries dem deport from America in recent months.

On Monday, Eswatini accept 10 deportees despite legal challenges, and dat add to di earlier group of five, wey di US bin describe as serious criminals.

However, Nigeria don tok say dem no go collect any US deportees.

Trump crackdown dey aim to deport millions of immigrants for US illegally.