Uefa Champions League table: Manchester City poor form dey worry Guardiola

Pep Guardiola wear black winter jacketas e use im hand bl;ock im eyes in sadness.

Wia dis foto come from, Michael Regan - UEFA/UEFA via Getty Images)

Wetin we call dis foto, Pep Guardiola, Manager of Manchester City, reacts aftan im team lose for di Uefa Champions League 2025/26 League Phase MD7 match between FK Bodo/Glimt and Manchester City for di Aspmyra Stadion on January 20, 2026 in Bodo, Norway.
Read am in 4 mins

Manchester City, Pep Guadiola and Bodo/Glimt dey trend since Tuesday night sake of dia Uefa Champions League result.

Bodo/Glimt knack 2023 Champions Manchester City akpako as dem sama dem 3-1.

Dis na di first ever win wey Bodo/Glimt don get for dia Champions League campaign for dis history.

For post match conference, Guardiola no happy at all, im tok say " We need to change di dynamic quick for di next game against Wolves and di next one against Galatasaray and we go dey wait make di players come back step by step."

Di multiple Uefa Champions League title winner say since dis new year start tins neva dey work well with di team.

"For some departments you know, without important players, you know wey dey give consistency to di team and dem bin no dey too strong like dem dey last season for certain periods but...dem fight 10 against 11 and a lot of players bin need to step up."

Guardiola add say nine of im important players bin no dey and dem dey give more consistency wen dem dey, I no feel say din team no well, i no agree with dat."

For Bodo/glimt body dey sweet dem as dem record dia first ever Champions League win for dia history.

Di Nowergian club don dey exist since 1916. Dis season dem don play seven matches and dem lose three, draw three and win one.

Na just 10 years ago, wey Bodo/Glimt bin dey compete for di second tier of Norwegian football. Since den, dem just dey improve.

Dem become champions of dia league four times for di past six years and runners-up two times.

Dem qualify dis season to reach di main stage of di Champions League for di first time.

Tuesday Results

UCL results

Wia dis foto come from, BBC Sport

Wetin we call dis foto, Champions League results
UCL results

Wia dis foto come from, BBC Sport

Wetin we call dis foto, Champions League results

Champions League Table

Premier League side Arsenal balance for top of di table wit 21 points, dem use six point pass Real Madrid wey dey second and Bayern Munich wey dey third.

Tottenham, Paris Saint Germain, Sporting CP, Manchester City, Atalanta, Inter Milan and Atletico Madrid complete di top ten.

Liverpool, Borussioa Dortmund, Chelsea and Barcelona dey di second half of di table.

Champions League table top nine

Wia dis foto come from, BBC Sport

Wetin we call dis foto, Champions League table top nine
Champions League table

Wia dis foto come from, BBC Sport

Wetin we call dis foto, Champions League table
Champions League table

Wia dis foto come from, BBC Sport

Wetin we call dis foto, Champions League table
Champions League table bottom six

Wia dis foto come from, BBC Sport

Wetin we call dis foto, Bottom six

Some fixtures for Wednesday

Uefa Champions League fixtures

Wia dis foto come from, BBC Sport

Wetin we call dis foto, Champions League fixtures