Why Caf sama Cameroon football President Samuel Eto'o anoda fine

Wia dis foto come from, ISSOUF SANOGO/AFP via Getty Images)
Di Confederation of African Football (Caf) don sama Cameroon Football Federation (Fecafoot) President, Samuel Eto'o Fils four-match ban and a fine of $20,000.
According to Caf, na sake of allegations of misconduct during di ongoing Africa Cup of Nations, Afcon, competition.
For statement, Caf say dem find Mr. Eto'o guilty of violating di principles of sportsmanship, during di quarterfinal match between Cameroon and Morocco.
For di match wey bin hapun on January 9, tori be say di Fecafoot president bin dey make angry gesture ova some of di decisions wey di officiating referee make.
Cameroon lose di match 2-0 to hosts Morocco.
E be like say di President of Caf, Patrice Motsepe wey bin dey for di stadium witness Eto'o frustration.
On January 12, di confederation bin announce say dem dey launch investigation into violent confrontations and unacceptable behaviour of some players and officials during matches.
Meanwhile, Fecafoot don reject Caf decision, dem describe di process as one wey dey "raises serious reservations about di fundamental requirements of a fair trial."
Di federation express support for dia president inside one statement on Wednesday, wia dem suggest say Mr. Eto'o go appeal di sanction.
Since im enta office as head of Cameroon Football Federation for 2021, Eto'o don enta several controversy.
Im bin don face accusations of improper conduct, poor management, wit some football stakeholders wey dey also complain of serious irregularities within Fecafoot.
Di 44-year-old former striker don reject dis allegations many times.
Samuel Eto'o Fils na one of di best footballers wey Africa don get. Di Cameroonian forward bin play for big clubs Real Madrid for 1996 at di age of 16 before e go on loan for Leganes, Espanyol and Mallorca. Im bin al;so play for Barcelona
For 2006, Eto'o become di first and only African to win di Spanish Golden Boot afta e net 26 times in 34 matches.
Di forward score 108 goals in 144 games for di Nou Camp side before e join Inter Milan for 2009, wia e win im third Champions League crown as well as Serie A title and di Fifa Club World Cup for 2010.
Internationally, Eto'o epp di Indomitable Lions to win two successive Africa Cup of Nations for 2000 and 2002 and go on to become di tournament record scorer with 18 goals.
For 2000, e guide Cameroon to Olympic gold medal, wia e score for di final.








