Dortmund vs Barcelona, Aston Villa vs PSG UCL Champions League quarter-final second leg preview

Wia dis foto come from, Getty Images
Dortmund go jam Barcelona on Tuesday 15 April for di second leg of dia Champions League quarter-final match.
Na so Paris Saint Germain dey travel to face Aston Villa for England.
Di winner of dis games go enta di semi-finals of di ogbonge competition and wait for di winners of di two oda games on Wednesday; (Real Madrid vs Arsenal and Inter Milan vs Bayern Munich).
Some football fans tink say Barcelona and PSG don already qualify for di semi-final afta dia first leg quarterfinal results; (Barcelona 4 - 0 Dortmund, PSG 3 - 1 Aston Villa).
But dis na football, teams don stage comebacks, and sometimes di gods of football fit rewrite some of di football tori.
However you dey see am, di games still dey important, so wetin we sabi about di two games, wen dem go play di matches and wetin be di head-to-head record of di teams?

Wia dis foto come from, Getty Images
Dortmund v Barcelona preview
Dortmund neva beat Barcelona for any European competition (P6 D2 L4). If dem fail to win for di Signal Iduna Park on Tuesday, e go be dia joint longest winless run against one opponent for Europe along wit dia 7-game streak against Rangers between 1966 and 1999.
Di German club also neva win for three home games against Barcelona for European competition (D2 L1) including dia 2-3 defeat against Barcelona for di UCL group phase for December 2024.
End of Di one wey oda users dey read well well
Dortmund striker Serhou Guirassy don score 10 goals for 13 Champions League games dis season.
Di German club go expect dem go fit to find di net against Barcelona if dem wan stage comeback from dia 0-4 defeat for di first leg.
Dia coach Niko Kovac tok say, "We dey aware of di situation, we wan show team wey dey completely different for dis game."
"Miracles dey happun all di time, but we also sabi say Barcelona neva lose competitive match dis year, but we go face dem."
Dortmund play 2-2 draw wit Bayern Munich for dia last league game. Barcelona get narrow 0-1 win v Leganes.
But for Barcelona, dem bin win all dia three games against German teams for di Champions League dis season.
Dem beat Bayern Munich (4-1), dem beat Dortmund 3-2 for di group phase, wia dem sama dem again 4-0 for di first leg of di quarterfinal.
Bifor dis season, Barcelona bin lose 5 times in a row against German clubs for di competition by aggregate score of 19-2.
Robert Lewandowski bin score 60 goals for 59 Champions League games since im become 30 years.
Na only Cristiano Ronaldo bin score more for di competition for im 30s (68 goals for 74 games).
Raphinha don dey involved in 19 goals for 11 games dis season (12 goals, 7 assists) wia im fit become di third player to reach 20+ goal involvements for one single season afta Ronaldo (21 in 2013-14, 20 in 2015-16) and Robert Lewandowski (20 in 2019-20).
Barcelona get attacking trio (Lewandowski, Raphinha, Lamin Yamal) wey dey in form well well; for di first leg, dem all score - togeda dem get 27 goals dis seasons so far.
Hansi Flick team now dey unbeaten for dia last 24 games for all competitions (W20 D4) - all in 2025, wia Dortmund gatz try to stop dem.

Wia dis foto come from, Getty Images
If Dortmund succeed, dem go become only di second team for di history of di competition wey don overturn a four-goal first leg deficit.
Dortmund manager Niko Kovac go hope say im team go dey clinical and take dia chances, even though dem only win 4 of dia last 18 Uefa club competition games against Spanish teams (D5, L9).
Dem gatz score at least 4 goals v Barcelona to force extra time if Barcelona no score, even though many sabi pipo tink say e dey impossible. Dortmund go try dia best.
But Hansi Flick dey aware of di threat wey Dortmund fit offer.
"We dey enta dis game from 4-0 result, we bin dey try to play our best wia I tink say for dis kind games; we gatz dey focused and play our own game," Flick tok.
Im add say "dis game go hard but I want make my team enjoy dia football against one of di most important teams for Europe".
Possible lineups Dortmund vs Barcelona
Dortmund: Kobel (GK), Süle, Can, Anton, Ryerson, Nmecha, Scenason, Chukwuemeka, Gross, Beier, Guirassy
Player wey fit miss di semi-final first leg if dem manage to qualify wit booking : Adeyemi, Beier, Couto, Guirassy, Ryerson, Sabitzer
Barcelona: Szczesny (GK); Koundè, Cubarsi, Inigo, Martin, De Jong, Lopez, Pedri, Yamal, Lewandowski, Raphinha
Player wey fit miss di semi-final first leg if dem manage to qualify wit booking: Inigo Martinez
Aston Villa v PSG preview

Wia dis foto come from, Getty Images
For di first leg for France, Dèsire Douè, Khvicha Kvaratskhelia and Nuno Mendes bin score afta Aston Villa first and only goal by Morgan Rogers.
PSG na di second team for Europe wey dey in form well well; in fact, dem already win di French League wit about six games to di end of di season.
PSG don dey play for di fourth consecutive Champions League quarter-finals and dem dey expect to enta di semi-finals.
For di English club Aston Villa, even though dem bin lose di first leg 1-3 for France, dem still get hope say dem fit do somtin for dis second leg.
Aston Villa bin win 10 of dia last 12 Uefa competition matches for dia home wia dem go dey confident to stage comeback for di Villa park.
Dem also bin score first for 8 out of dia 11 Champions League games dis season.

Wia dis foto come from, Getty Images
Aston Villa v PSG Possible lineups
Aston Villa: Martinez (GK); Cash, Konsa, Mings, Digne, Kamara, Tielemans, Roger's, McGinn, Rashford, Watkins
Pipo wey go miss di semi-final if dem collect yellow card for dis game: Digne, Disasi, Kamara, Rashford
PSG: Donnarumma (GK), Hakimi, Marquinhos, Pacho, Nuno Mendes, Joao Neves, Vitinha, Fabian Ruiz, Douè, Dembèlè, Kvaratskelia
Pipo wey go miss di semi-final if dem collect yellow card for dis game: Fabian Ruiz
Both games go happun at 8 PM (WAT); 7 PM GMT














