Watch how Mount Etna explode as large smoke rise from volcano
- Author, Esme Stallard
- Role, Climate and science correspondent
- Author, Alex Boyd
- Role, BBC News
Mount Etna for Italy don explode, and ogbonge ash and smoke rise from di volcano.
Pictures and video from di island of Sicily show as volcanic material dey pour comot from di volcano on Monday morning.
Italy National Institute of Geophysics and Volcanology (INGV) Etna Observatory say dem record explosions of "increasing intensity" for di early hours on Monday morning.
Di full scale of di eruption neva dey clear and di disruption e cause be like say e no too much.
Mount Etna na one of di world most active volcanoes, so eruptions na normal tin and di explosion dey rarely cause significant damage or injury.
Ground movement show say di latest eruption happun for di south eastern edge of di volcano, according to INGV.
Videos wey dem share throughout Monday show mixture of ash, gas and rock – wey dey known as pyroclastic flow – di video show as e dey comot from di site and as e dey move down di side of di volcano.
Geologists wey dey monitor di eruption tok say e dey likely say part of di volcano crater don collapse.
Pyroclastic flow fit dey very dangerous to di surrounding area, but e no show say e fit be threat.
For dia most recent update, INGV tok say di volcanic material neva pass di Valley of di Lion, di place wia tourists dey gada.

Wia dis foto come from, INGV
INGV say dem first record changes for di volcano activity at 00:39 local time (22:39 GMT), bifor dem clear am say na ongoing "Strombolian" eruption.
Di size of Strombolian eruptions dey vary but di explosions dey happun one afta di oda. E dey happun sake of di presence of gas for di magma chamber within di volcano.
Wen di gas bubble reach di surface, dem fit burst suddenly, and begin throw material skywards.
These types of eruptions fit dey particularly dangerous for nearby aircraft.
Authorities reportedly issue red alert on Monday, to possibly suspend flights wey dey operate nearby, but dem later bring am down.
Mount Etna last notable eruption happun for February and e make di island Catania airport to divert dozens of flights sake of ash clouds.
Authorities don also warn tourists to comot from di volcano lava flows.






