Ogbonge fotos show how volcano explode for Iceland
Wia dis foto come from, KRISTIN ELISABET GUNNARSDOTTIR
Wetin we call dis foto, Di region around di capital Reykjavik don dey experience increase in earthquake activity since late OctoberArticle Information
Author, Production by Mike Hills, picture research by Emma Lynch and Matthew Tucker, development by Becky Rush.
Role, By the Visual Journalism Team
One volcano don explode for Reykjanes peninsula of south-west Iceland afta weeks o earthquake activity.
Dem don evacuate 4,000 pipo from Grindavik, one fishing town wey dey about 4km (2.5 miles) away, last month.
Di eruption bin start north of di town for 22:17 local time (22:17 GMT) on Monday, di Icelandic Met Office tok.
One resident wey dey live near Grindavik describe di scenes as "crazy" and "scary" scenes, and she say she still fit see di volcano dey explode on Tuesday.
Since late October, di region wey dey around di capital Reykjavik don dey experience increase in earthquake activity.
Wia dis foto come from, Getty Images
Wetin we call dis foto, Foto show as lava dey burst from di volcano
Wia dis foto come from, ICELANDIC COAST GUARD
Wetin we call dis foto, Footage from above show as lava burst from di volcano just one hour afta dem detect earthquake swarm, or seismic events.
Wia dis foto come from, Anadolu
Wetin we call dis foto, Di explosion turn di sky over south-west Iceland orange and dem fit see di smoke wey dey comot from there for Reykjavik, wey dey about 42km north-east of di volcano.
Wia dis foto come from, Instagram @zwyzszejperspektywy
Wia dis foto come from, OSKAR GRIMUR KRISTJANSSON
Wetin we call dis foto, Houses for di village of Hafnarfjordur wit smoke dey comot from am for distance, and lava paint di night sky orange - following one volcanic eruption for di Reykjanes peninsula, western Iceland
Wia dis foto come from, EPA
Wetin we call dis foto, Di length of di crack for di volcano dey about 3.5km, di lava bin dey flow at a rate of around 100 to 200 cubic metres per second, according to di Icelandic Met Office.
Wia dis foto come from, Civil Protection of Iceland
Wetin we call dis foto, Footage from above show lava dey burst from di volcano just one hour di earthquake, or seismic events, bin dey detected.
Wia dis foto come from, ICELANDIC COAST GUARD/HANDOUT/EPA-EFE/Shutterstock
Wetin we call dis foto, Iceland don dey on high alert for one potential volcano eruption for several weeks and dem don order local residents to leave as a precaution. No reports of injuries dey.