Amazon launch dia first Kuiper internet satellites

Amazon Kuiper

Wia dis foto come from, Getty Images

Read am in 3 mins

Amazon Kuiper broadband internet constellation launch di first 27 satelites to space from Florida on Monday.

Dem kick off di long-delayed deployment of internet-from-space network wey go rival SpaceX Starlink.

Di satellites na di first of di 3,236 wey Amazon dey plan to send to low-Earth orbit for Project Kuiper, one $10 billion effort wey dem bin unveil for 2019 to beam broadband internet globally for consumers, businesses and goments - customers wey SpaceX get for years wit dia powerful Starlink business.

Sitting on top Atlas V rocket from Boeing (BA.N), e open new tab and Lockheed Martin (LMT.N), open new tab joint-venture United Launch Allian.

Di batch of 27 satellites bin enta space at 7 p.m. EDT pm from di rocket company launch pad wey dey for Cape Canaveral Space Force Station.

Bad weather bin affect di initial launch attempt on April 9.

Reuters report say Kuiper na arguably Amazon biggest bet so far to challenge Starlink as well as global telecommunications providers like AT&T (T.N), e open new tab and T-Mobile (TMUS.O), open new tab.

Di company don position di service as a asset wey go help rural areas wia connectivity dey scare or no dey at all.

Di mission to deploy di first operational satellites dem bin delay am for more dan a year - Amazon bin hope say dem go fit launch di inaugural batch for early 2024.

Di company dey face one deadline wey U.S. Federal Communications Commission bin set to deploy half dia constellation, 1,618 satellites, by mid-2026, but dia slower start mean say Amazon go likely seek extension, an wetin analysts tok.

Hours or possibly days afta di launch, Amazon dey expected to publicly confam di initial contact with all of di satellites from dia mission operations centre for Redmond, Washington.

If all go as planned, di company say dem expect to "begin deliver service to customers later dis year."

ULA fit launch up to five more Kuiper missions dis year, ULA CEO Tory Bruno tell tori pipo Reuters for interview dis month.

Amazon say for one 2020 FCC filing say dem go fit begin service for some northern and southern regions at 578 satellites, wit coverage wey go expand toward Earth's equator as di company launch more satellites.

Di Web services and e-commerce giant Project Kuiper na ogbonge move into space, wey start late for market wey dey dominated by SpaceX.

But Amazon executives see di company deep consumer product experience and established cloud computing business wey Kuiper go connect as advantage ova Starlink.