Tori of Inspector Edith wey catch fellow officer dey allegedly rape 17 year old suspect - police defend dia action

Read am in 4 mins

Nigeria Police don tok about di viral video of 17 year old wey dem allegedly rape for Edo state police station.

For statement wey dey release on Wednesday, dem reveal say dem don dismiss both di pesin wey record di video, Edith Uduma wey be Charge Room officer and di alleged rapist, Abraham Uzuobo, wey currently dey prison.

Di video wey don spread for social media show as Abraham dey struggle to wear trouser to cover di exposed part of im lower body.

Di video den show di alleged victim, for chair wey look like she no dey awake as she wear short black dress for di office.

BBC neva fit independently verify di video.

According to di statement, wetin happun e say ,"di video bin comot for social media, one week afta e happun. Ogbonge investigation into di mata wey di Edo State Police Command bin show say Sgt Abraham Uzuobo remove di girl from cell come try nack am for office wia nobodi dey," Force tok-tok pesin Olumuyiwa Adejobi tok for di statement.

Di Force PRO add say "Na for di middle of di assault, Uduma come inside and record wetin dey happun. But instead of am to report di case di standard way, she use di opportunity call her husband Ibrahim Mohammed to gbab one million naira ($593) from di sergeant to hide di mata."

Di police go on for dia statement to tok say Abraham bin give dem 45,000 naira dat day but dem try blackmail am again and wen e refuse na wen dem report di mata give di DPO and post di video for social media

Howeva, Edith Uduma wey lose her job on top di mata don start to dey hala say wetin di police dey tok no be wetin happun and she actually report di mata on di day wey e happun.

She bin also refuse di accuse say she collect any bribe for di alleged rapist hand.

For interview wey she bin run wit di SSA to di Delta State Govnor, Harrison Gwamnishu, she tok say di 45,000 naira wey police dey claim say dem use settle am and her husband, na di money e bin give pesin to dead di mata.

For video wey she dey cry on 16 November, she begin dey cry say she no do anytin wrong and she bin report di mata as soon as e happun, and she no wan go court as she no do anytin wrong.

She tok say, "Sgt Abraham come my side come collect cell key say im wan release suspect from cell, I come give di key ot cell guard make follow Abraham go open cell. I no see Abraham or di key till anoda team bin don come to detain dia suspect, I call Abraham and e come ansa me say e bin wan release anoda suspect. Afta 35 minutes I neva see am again. So I come dey find am. Na so I enta di room see wetin I dey see start to dey record."

She show for the clip proof say she send the video give di right chain of command and even show wia she for document di mata for crime diary even afta her DPO say make she no do am.

For di 30 minutes video, she accuse her DPO say, she bin wan cover di mata of di rape make e for no affect her retirement.

She tok say she bin neva send di video to Sgt Abraham to ask am for money but she send am toher oda colleagues, Station Officer and Area Commander.

Afta which dem bin tiff her phone.

Uduma tok say di whole gbas-gbos as to weda she don lose her job bin dey affect her mental health.

She add say, "if I bin wan blackmail Abraham, I no go send di video give anybodi, na im and me go just settle am. But me no be di kain pesin wey go see dat kain tin turn eye."

She end di mata say, "I ready to go any panel to tok my tori say I no blackmail anybodi and say na lie say Abraham give 45k to my husband."

Howeva police maintain say to comot Edith Uduma dey very necessary bicos "of di ogbonge evidence wey show her failure to follow standard incident report protocol to immediately document di mata and her attempt to hide offender for benefit and join for extorting and manipulating di justice process for personal gain".

Dem report say Sgt Abraham Uzuobo don dey dismissed from service and dey prison as trial dey go on and Edith Uduma husband don dey demoted to corporal.