Why Ebola dey deadly - symptoms and prevention of di virus

Man wear yellow overal to protect imsef, e wear blue gloves and use white nosemask while e dey stand for makeshift tent

Wia dis foto come from, John WesselsAFP via Getty Images

Read am in 4 mins

Ebola virus outbreak na deadly occurence wey don touch plenti African kontris wey lead to death of thousands.

Di virus dey start wit sudden fever, weakness of di body, muscle pain and sore throat, and dis dey common for different kontris as symptoms.

Howeva, di latest of di outbreak na for Democratic Republic of Congo wia at least 15 pipo don die for di fresh outbreak of di virus, according to di kontri health ministry.

For DR Congo, na one 34-year-old pregnant woman dem first disocva di virus for her body for August dis year, afta she show symptoms and she later die sake of organ failure.

Dat na di 16th outbreak of di deadly virus for di central African state since dem first discover di virus for di kontri for 1976.

Ogbonge health body World Health Organisation don try do several tins ontop di virus mata but e still dey show face.

For 2022, Uganda witness serious Ebola virus outbreak wia dem confam ova 31 cases wey make dia govment fear.

Ebola enta Nigeria for 2014 wen Patrick Sawyer, wey be diplomat for Liberia, cari di virus enta wen im fly go di kontri, and dat time, na about eight pipo bin die.

Oda kontris for West and Central Africa Ebola virus don touch include; Guinea, Uganda, Liberia, and Sierra Leone, plus plenti odas

Wetin be Ebola and how e dey spread?

Ebola disease na serious, infectious and fatal sickness. Di virus bin originate from fruit bats, according to WHO.

Dis disease dey infect humans through close contact wit infected animals, including chimpanzees, fruit bats and forest antelope.

Na fruit bats first cari Ebola enta village to village begin nack pipo wit di disease afta dem touch blood, bodi parts and water of animals wey dey infected.

E get two strains of di Ebola virus: Sudan and Zaire.

Human to human infection na through direct contact wit infected blood, vomit, faeces or bodily fluids. Dis fit be through broken skin, or mouth and nose.

Funerals of Ebola victims also dey risky, if mourners get direct contact wit di body.

Symptoms of Ebola virus and why e dey deadly

Ebola na deadly virus wey im initial symptoms fit include sudden fever, serious weakness, muscle pain and sore throat.

Advance stages fit include vomiting, diarrhoea and - in some cases - both internal and external bleeding, wey dem dey call haemorrhaging.

Di incubation period fit last from two days to three weeks and Ebola fit dey associated wit oda sickness like malaria and typhoid.

Pipo dey catch am wen e get direct contact with dia skin wey get wound, mouth, nose, with blood, vomit, poo-poo or water from di body of pesin wey get Ebola.

Patients dey die from lack of water for dia body and multiple organ failure.

How you fit prevent Ebola virus

Di deadliest Ebola outbreak on record na for 2014 for West Africa wit ova 11,000 pipo wey die. Dat epidemic kill five times more dan all oda known Ebola outbreaks wey don happun.

Now, how you fit keep yourself safe and prevent di virus:

  • Wash your hands evri time wit soap and water - Health pipo say make we wash hands wit soap and water and clean surfaces wit chlorinated water.
  • No dey touch pipo wey don dey infected - To prevent more of di infection, health professionals advise make pipo avoid contact wit pipo wey dey infected, including for dem to stop to shake hands.
  • Avoid deadi bodies
  • No dey kill, touch or chop bush meat

E get vaccine for di Zaire strain of Ebola, wey dey common for di past for Democratic Republic of Congo. And currently no approved vaccine dey for di Sudan strain of Ebola.

Howeva, early treatment of specific symptoms, fit improve survival of di pesin wey get am.

For medical teams, dem must wear full Personal Protective Equipment, PPE, wen dem dey attend to cases to prevent infection. Deadi bodi dem, for any body bag, must dey buried by pipo wey dey wear proper PPE.