‘Why we dey reduce di number of immigrants wey go come Canada’ - Prime Minister Justin Trudeau

Wia dis foto come from, Getty Images
Di Prime Minister of Canada Justin Trudeau don tok why dem dey reduce di number of immigrants wey go come Canada for di next three years.
Trudeau say di decision to reduce di number of immigrants for di next three years, na sake of say some bad pipo don hijack im kontri permanent immigration policy.
Trudeau yarn dis one for one YouTube video wey im release on Sunday.
Di PM agree say im goment make some mistakes for di immigration policies, but now dem dey make one big u-turn to correct am.
E say im goment suppose don act faster to address di k-leg wey bin dey immigration programmes.
“Bad actors like fake college dem and multinational companies dey take advantage of our immigration system for dia own interest,” di Canada leader tok.
Oga Trudeau say di kontri population explode just inside two years.
“Inside di last two years, our population don grow really fast, like ‘baby boom’ fast,” im tok.
Covid affect permanent and temporary immigration
One of di major tins wey affect di immigration system be say, afta di Covid-19 pandemic, Canada gatz increase immigration to boost di labour market and prevent recession.
Canada get two kinds of immigration. One na temporary, di oda na permanent.
Usually, di PM explain, na di permanent residents na dem di goment dey torchlight pass.
Dem no dey too send di oda temporary residents becos dem believe say na di economy go determine dat one.
Dis na sake of say, bifor now, temporary immigrants na veri small portion of dia population, so dem no see am as part of di long term immigration plan.
Di permanent immigration na di one wia pipo dey go di kontri to settle and build dia new home.
Oga Trudeau say, “evri year, di goment dey decide di right number of permanent residents wey we want make dem come. Dat na how dem dey do am for years.”
But according to di prime minister, immigration story no go complete if dem tok about permanent immigration witout di temporary immigration.
Temporary immigration na for temporary residents wey dey go live for Canada for some time. Dem include international students, temporary workers plus odas.
Once dis pipo finish dia school or work, dem must return home, although some fit apply to stay.
But afta Covid pandemic, dia economy bounce back fast so therefore dem bin need plenti workers sharply.
Oga Trudeau say, sake of dis post-Covid need, temporary residents become major part of di workforce, and na why dem finally include dem for dia immigration level plan.
Dis na di first time wey Canada dey set target for both permanent and temporary residents.
Dis time, di goment say dem go torchlight evri province for dia territory to find out from di premiers di different need wey dem get.
Dem go try solve problems like, di gap for dia workforce, di age of di population - young or old.
Trudeau say di informate wey dem gada from business owners, CEOs and experts go help goment sabi di areas wia dem go set dia targets.
Opportunity to profit
Di post-Covid immigration needs turn opportunity for some bad pipo to make profit.
Di number one man for Canada say too many big companies begin game di immigration system.
“Far too many colleges and universities use international students to raise dia bottom line… becos dem fit charge dis students tens of thousands of dollars or more for di same degree.
“Den, e get some really bad pipo wey dey cheat pipo, dem dey target vulnerable immigrants wit promise of jobs and diplomas, and easy road to citizenship. Promise wey no go eva come true,” Oga Trudeau tok.
Canada no longer need additional help
Canada goment say di pandemic boom don cool, and now di businesses no need di additional help. Time don reach to make adjustments wey go stabilise di immigration system, so e go work for Canadians.
Trudeau say di immigration plan dey veri straightforward - Na to reduce pipo wey dey come Canada, weda dem be temporary or permanent.
Dis new plan go mean say di kontri go reduce population of permanent immigrants by 20%.
Temporary immigrants like international students and temporary foreign workers go also seriously reduce.
“We dey prioritise permanent residents wey get di skill wey we need, like health care workers for our hospitals and construction workers wey go build more homes,” im tok.
What about temporary residents wey don already enta Canada?
Di number one man say, some of dem go apply to stay for Canada as permanent residents, as per say dem don already settle dia dey work.
But again im say, dem go leave di kontri wen dia temporary residency expire, dis way dia population go reduce.
Also, some temporary residents go fit wan use shortcut stay for di kontri by applying for di asylum system wen dia visa expire.
But Trudeau say, asylum no be automatic as goment go analyse and process dia claims, and if dia claim na lie, na home straight.
Di kontri dey plan to press pause for population growth for di next two years, 2025 and 2026, and believe say e go begin balance from 2027.
Prime Minister Trudeau say dis pause go give di economy and communities di chance to catch up and return to di pre Covid era population.










