Inec declare APC Lucky Aiyedatiwa winner of Ondo governorship election

Lucky Aiyedatiwa win im hand stretch out

Wia dis foto come from, @LuckyAiyedatiwa

Read am in 4 mins

Di Independent National Electoral Commission (Inec) don declare candidate of di All Progressives Congress (APC) Lucky Aiyedatiwa as winner of Ondo state govnorship election.

Aiyedatiwa defeat im closest rival, oga Agboola Ajayi of di Peoples Democratic Party.

Di collation officer, Prof Olayemi Akinwunmi, wey be Vice-Chancellor of di Federal University Lokoja make di declaration on Sunday afternoon.

Dis na afta di collation wey start on Saturday night for election wey see low turn out of voters.

Prof Akinwunmi declare say APC poll 366,781 votes while PDP get 117,845 votes.

Di race na battle of di two deputies wey don work wit late Rotimi Akeredolu.

Ajayi be deputy to Akeredolu for di first term of di late govnor from 2017 bifor serious gbege happun between dem for 2020.

Na wetin make dem separate - dem late face each oda for di 2020 guber election wey e lose.

Meanwhile, by 2020 Aiyedatiwa don become running mate wit late Akeredolu and wen im oga die for 2023, dem declare am as govnor.

Profile of Lucky Aiyedatiwa

Like im first name ‘Lucky’ mean, plenty pipo don tok say na luck bring am to di position of govnor of Ondo state. Even im middle name ‘Orimisan’ wey mean ‘my head is good’ fit also dey work for im life.

Lucky Aiyedatiwa na native of Obe-Nla for Ilaje Local Government Area of Ondo State. Dem born am on 12 January, 1965 into di family of Mr. Titus Akande and Mrs. Rosanah Moyebi Aiyedatiwa (of blessed memory).

Between 1970 to 1976, Aiyedatiwa bin attend Saint Peter’s UNA (now FAC) Primary School, Obe-Nla/Obe Adun in Ilaje for im elementary education and in 1982, im go Ikosi High School, Ketu, Lagos for im secondary education.Still hungry for more, Aiyedatiwa proceed go Lagos State College of Education (now Adeniran Ogunsanya College of Education), Ijanikin for 1986, wia e study Economics and Government and collect im Nigeria Certificate in Education (NCE).

Di new govnor become classroom teacher wia e teach for a period of time before e enta business and establish im own business for 1996.

Aiyedatiwa bin join politics for 2011 wen e become member of Action Congress of Nigeria (ACN) den All Progressives Congress (APC) for 2014.

Former President Muhammadu Buhari bin appoint Lucky Aiyedatiwa as Federal Commissioner wey go represent Ondo State for di Board of Niger Delta Development Commission (NDDC) between 2018 to 2019.

For di 2015 presidential and national assembly general election, im become di APC House of Representative candidate for Ilaje/Ese-Odo federal constituency, afta im represent Ondo state as delegate for di party national convention wey happun for 2014.

From 2004 reach 2010, Aiyedatiwa bin serve as National Public Relations Officer (PRO) for Association of Bureau De Change Operators of Nigeria (ABCON) and chairman of south-west zone of ABCON from 2010 to 2011.

For 2021, Chartered Institute of Local Government and Public Administration of Nigeria (CILGPAN) give platinum award to Aiyedatiwa and before dat, im serve as MD/CEO of Blue Wall Group of Companies wey get about three oda company under am.

For 2001, im attend University of Ibadan for im advanced diploma in Business Administration before becoming an alumnus of Lagos Business School – Pan Atlantic University, Lagos for 2009 wia e get post graduate certification for Chief Executive Education (CEP) in Business Management.

For 2013, im also bag im Masters degree in business Administration from di University of Liverpool, United Kingdom.

In February 2021, dem swear-in Akeredolu and Aiyedatiwa as govnor and deputy afta dem win di October 2020 govnorship election for Ondo state.

For 2023, na two times Aiyedatiwa become acting govnor of Ondo state - first in July 2023 wen di late Govnor Rotimi Akeredolu bin dey medical leave den December 2023 wen President Tinubu finally bin chook mouth say make dem transfer power to am.

Same December 2023, few weeks wey Aiyedatiwa collect power as acting govnor of Ondo state, dem swear am in as govnor following di death of di incumbent Akeredolu wey pass on due to cancer.