You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Ogbonge fotos show how volcano explode for Iceland
- Author, Production by Mike Hills, picture research by Emma Lynch and Matthew Tucker, development by Becky Rush.
- Role, By the Visual Journalism Team
One volcano don explode for Reykjanes peninsula of south-west Iceland afta weeks o earthquake activity.
Dem don evacuate 4,000 pipo from Grindavik, one fishing town wey dey about 4km (2.5 miles) away, last month.
Di eruption bin start north of di town for 22:17 local time (22:17 GMT) on Monday, di Icelandic Met Office tok.
One resident wey dey live near Grindavik describe di scenes as "crazy" and "scary" scenes, and she say she still fit see di volcano dey explode on Tuesday.
Since late October, di region wey dey around di capital Reykjavik don dey experience increase in earthquake activity.