Noa Argamani among Israeli hostages IDF rescue free afta raid in central Gaza
- Author, Alex Therrien
- Role, BBC News
- Reporting from, London
Dem don rescue four Israeli hostages wey Hamas kidnap from di Nova music festival during di 7 October attack during daylight raid for central Gaza.
Noa Argamani, wey be 25 years, Almog Meir Jan, 21, Andrei Kozlov, 27, and Shlomi Ziv, 40, na di pipo wey dem free afta one "high-risk, difficult mission" from two separate buildings in di Nuseirat area, di Israel Defense Forces tok.
Di IDF tok say di four dey in good medical condition and dem don transfer dem to di 'Sheba' Tel-HaShomer Medical Center for further medical examinations - wia dem take dia foto as dem dey embrace dia family members, wey don dey wait for dem at di facility.
Gaza Hamas-run health ministry tok say dem don kill and injure dozens of pipo, including children in di operation, fotos dey show di significant numbers of casualties.
Staff at di Al-Aqsa hospital tok say dem dey struggle to treat di casualties.
"Dozens of injure pipo dey lie on di ground and medical teams dey try to save dem wit di simple medical capabilities dem get," di ministry tok on Facebook.
'Precise intelligence'
Na joint operation of di IDF, Israel Security Agency and Israel Police conduct di rescue of hostages - wey come eight months into war wit Hamas for Gaza.
IDF tok-tok pesin Daniel Hagari tok say di mission na based on "precise" intelligence and Israeli forces dey unda fire during di operation.
End of Di one wey oda users dey read well well
For one news conference, oga Hagari tok say one Israeli soldier dey badly injured.

Wia dis foto come from, Reuters
Miss Argamani, Chinese-born Israeli citizen, wey dem kidnap from di Nova festival and harrowing video footage from 7 October show di 25-year-old wey dem dey carry away on di back of motorbike dey shout, "No kill me!"
New video show wen she reunit wit her papa, dey smile and hug am as dem enta moto, dem broadcast dis soon afta news of di rescue operation on Saturday.
Oga Kozlov, one Russian wey move to Israel in 2022, wey dey work as security guard for di festival wen dem kidnap am.
Oga Jan try to run from di festival. Im and one friend reach di friend car but dem only manage to drive witin short distance bifor dem stop.
Oga Ziv na part of di security detail for di festival and e initially dey contact wit im sisters as wen di attack start, according to one interview wit The Times of Israel.

Wia dis foto come from, Getty Images
Di Hostages Families Forum Headquarters, one group wey dey represent di families of di hostages, describe di rescue of di four hostages as “miraculous victory,” and thank di IDF for di “heroic operation”.
di group add: “Di Israeli goment must remember im commitment to bring back all 120 hostages wey still dey wit Hamas — di living for rehabilitation, di murdered for burial.”
In response to di military offensive in Nuseirat, Hamas political leader Ismail Haniyeh tok say Israel no fit force dia choices on di group.
E tok say di group no go agree to ceasefire deal unless e achieved security for Palestinians.
During di 7 October attack for southern Israel Hamas kill about 1,200 pipo and take some 251 pipo.
Some 116 wey dey remain for di Palestinian territory, including 41 di army tok say dem don die.
One deal for November make Hamas release 105 hostages in return for one week-long ceasefire and some 240 Palestinian prisoners for Israeli jails.
On Saturday, di Hamas-run health ministry tok say di death toll for Gaza now, na 36,801 pipo.


Wia dis foto come from, Reuters














