Israeli strike hit Rafah area hours afta Hamas bin fire eight rockets towards Tel Aviv

Isreal

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Damage from di strike on Sunday night show well-well di following morning
    • Author, Thomas Mackintosh
    • Role, BBC News

Plenti pipo don die and many odas wunjure for explosion wey happun for one refugee camp for Rafah area, na wetin Hamas-run health ministry for Gaza tok.

Videos from di scene for southern Gaza Strip show one big explosion and serious fires wey dey burn.

Di Israel Defense Forces (IDF) say dem bin target two senior Hamas leaders for one of di group compounds - dem add say dem go review reports of fire wey spread to shelters and harm civilians.

Dis strike dey come hours afta Hamas bin fire eight rockets from Rafah towards Tel Aviv, di first long-range attacks for di city since January.

For inside statement wey dem release afta di blast inside Gaza on Sunday night, di IDF say dem don "eliminate" two senior Hamas figures - Yassin Rabia and Khaled Nagar – for one "precise" air strike "for north-west Rafah".

Hamas attack

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Fire burn one displaced Palestinians area for Rafah on Sunday

Di IDF say dem bin target Hamas militants wit precision weapons.

Hamas-run authorities say 35 pipo na im di explosion kill and plenty pipo wunjure for one camp for displaced Palestinians wey dey north-west of Rafah, and away from recent military operations for one designated humanitarian safe zone.

Tori be say women and children dey among di pipo wey die.

Di number of pipo wey die dey likely to rise as search and rescue efforts kotinu for Rafah Tal al-Sultan neighbourhood about 2 km (1.2 miles) north-west of di city centre, one Palestinian Red Crescent Society tok-tok pesin tok for Associated Press news agency.

One eyewitness tell Reuters news agency say di whole neighbourhood for Tal Al-Sultan dey "burnt".

Anoda witness, Fadi Dukhan, say im bin dey sidon for di door of one house wen im hear di explosion.

"All of a sudden we hear di sound of one missile," im tell Reuters. "We run oh come find street wey one street wey smoke cova. We no see anytin."

"As I enta one house," Im add, "I no find anybodi inside but later we find one girl and one young man wey get cut into pieces".

Isreal

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Israelis bin take cova during rocket fire near Herzliya on Sunday

Earlier on Sunday dem hear air raid sirens sound around Tel Aviv as central Israel bin come under attack by Hamas rockets, wey dem fire from close to Rafah.

Di eight rockets bin dey either intercepted by air defence systems or fall for fields.

Israel military offensive bin kotinu for Rafah, despite di International Court of Justice ruling on Friday to say e must stop.

Di rocket barrage show di kain threat Hamas still pose to pipo across Israel, although no reports of injuries.

E also show di challenges wey di Israeli army dey faces as dem move further into southern Gaza to comot Hamas from wetin dem call di “last major stronghold”.

Di military wing of Hamas say dem act in response to "di massacre of civilians".

Di rocket attack come ahead of further ceasefire negotiations between Israel and Hamas, wey dey expected to resume next week.

Israel bin begin dia long-anticipated offensive for Rafah about three weeks ago, wia dem vow to destroy di remaining Hamas battalions dia.

Tori be say na dat town dem hold di Israeli hostages.

More dan 800,000 Palestinians don run from Rafah since di fight-fight start, according to UN.

About 1.5 million pipo bin dey stay dia sake of di fight-fight wey dey happun for oda places for Gaza.

Israel military campaign for Gaza bin start afta Hamas gunmen attack Israel on 7 October, wia dem kill about 1,200 pipo and take 252 oda back to Gaza as hostages.

Nearly 36,000 Palestinians don die since di war start, according to Gaza Hamas-run health ministry.