ECG explain why some areas for Ghana dey experience black-out

Wia dis foto come from, Getty Images
Some Ghana electricity consumers dey experience darkness for about four days now sake of systems challenges for Electricity Company of Ghana (ECG).
Thousands electricity consumers dey complain say dem no dey fit buy electricity credit from vendors.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
“I turn plenty customers away yeste sake I no fit load credit on dia card. ECG talk we say dem dey address de challenge but dis dey create inconvenience give de customers” ECG vendor, Cynthia Mensah talk BBC Pidgin.
Some customers dey sleep in darkness, people wey dey preserve food with fridges dey experience rot, businesses wey depend on electricity dey shut down wey others dey spend more money on fuel to power generators so say dem go get power.
But why e dey happen? ECG try explain dis challenge and how dem dey solve am.
Nationwide challenge in metering system

ECG say dem dey experience nationwide challenge in dia metering system, dis make am impossible for some customers to buy credit despite say power dey flow.
“De Electricity Company of Ghana (ECG) currently dey experience some technical challenges in relation to de prepaid metering system nationwide, wey don result in some customers unable to recharge prepaid electric power credit on prepaid metres for de past four days or so now” ECG talk in dia statement.
Areas wey dey affected
According to ECG, customers no go fit use dia PNS and e-cash services until dem manage resolve de situation.
End of Di one wey oda users dey read well well
De technical challenge affect customers in 10 operational regional areas of de ECG:
- Volta
- Kumasi
- Accra
- Takoradi
- Tema
- Cape Coast
- Kasoa
- Winneba
- Swedru
- Koforidua
- Nkawkaw
- Tafo
Wen ECG go resolve de situation?
External Communications Manager for ECG, Charles Nii Ayiku explain say “we fix some of de systems but no be all. We detect de challenge wey we fix am but some of de systems no respond to de solution.”
“We no go fit give time for total restoration but we dey work on am” Charles Nii Ayiku add.













