Wetin you need to sabi about Melania Trump documentary wey South African company comot from theater

Read am in 4 mins

Di distributor company wey wan drop di film "Melania" on Friday, tok say dem don cancel di show becos of "recent developments," wey dem no fit explain.

Thobashan Govindarajulu, head of sales and marketing for Filmfinity for South Africa tok say base on di rfecent development di company don decide say dem no go show am for di territory, according to South Africa-based website News24.

Govindarajulu tok say di company no dey under any pressure to pull di film from di theatre.

"Based on di recent development, we don decide say we no go fit go ahead wit any theater release for di territory," e tok.

Di decision to pull di film for South Africa happun wen South African govment and Oga Trump get deep hostility between dem.

Trump don dey criticise South Africa govment since im enta office for im second term. South Africans dey vex say e dey dey spread false information about di kontri and di heavy tarriffs e impose on di kontri.

Wetin we know about Melania Trump documentary

For many first ladies dem go wan quietly stay off spotlight but Melanin wan archive her private life in di White House into di every story of di American pipo.

Wit di "Melania" documentary, she allow make camera follow am for 20 days as she return to White House, di first lady drop di private life wey she bin dey live to become paid executive producer of her own story - dis move turn di presidential transition to blockbuster cinema.

"I be private pesin and very selective – wetin I dey do, wetin I no dey do, wen I go tok, when I go no tok. Na my choice, and nobody dey in charge of my life," Trump tok during her appearance for Fox News, on Wednesday.

"Melania" go premiere on Thursday evening to some ogbonge pipo wey dey within Donald Trump Cabinet, celebrities, and Chrisley family of reality TV fame, rapper Waka Flocka Flame and financial criminal "Wolf of Wall Street" Jordan Belfort. Di feem go get invitation-only premiere screening for 21 cities.

Wetin to expect from di documentary

Di main gist of di one hour, 44-minute feem wey don dey keep everybody waiting be say e show di private life of di Trump's.

Di summary of di documentary promise "exclusive footage wey go show critical meetings, private conversations, and never-before-seen environments."

Although tori-pipo need see di feem but Fox News Maria Bartiromo and Newsmax Greta Van Susteren dey among di pipo wey go gada dey di red carpet for Kennedy Center.

Melania Trump dey among di pipo wey produce di feem and she get editorial control on di production, post-production and promotional aspect of di feem.

Na Brett Ratner direct di feem and na im first major work since 2017, wen dem accuse am of sexual misconduct.

Di themes wey dem show for di documentary na di first lady love for fashion wit her longtime designers Hervé Pierre and Adam Lippes, wey design her navy Inauguration Day coat.

Dem show family issues wit her son Barron Trump, father Viktor Knavs and di president (but none of her stepchildren dey di feem).

Members of her small team also show: chief of staff Hayley Harrison, White House visitors office director Alexandra Veletsis and longtime aide Justin Caporale.

Photographer Régine Mahaux, hairstylist Mordechai Alvow, makeup artist Nicole Bryl and interior designer Tham Kannalikham also dey for di feem.