Why US wan send jets and warships to Israel as Iran dey threaten dem

One US Air Force F-16 fighter jet

Wia dis foto come from, Getty Images

    • Author, Graeme Baker
    • Role, BBC News
    • Author, Jenny Hill
    • Role, BBC News
    • Reporting from, Tel Aviv
  • Read am in 4 mins

Di US wan send additional warships and fighter jets go di Middle East to help defend Israel from possible attacks by Iran and dia proxies, di Pentagon tok.

Tensions still dey high for di region ova di assassination of Hamas leader Ismail Haniyeh for Iran and one key commander of di Lebanese militant group Hezbollah.

Pentagon say dem don place missile defence forces on state of increased readiness to deploy, plus say dia commitment to defend Israel dey "ironclad".

Iran leader Ayatollah Khamenei don vow "harsh punishment" against Israel for di assassination of Haniyeh.

Iran say Hamas leader dey killed from close range

One soja stand next to one banner wey get foto of Hamas political leader Ismail Haniyeh

Wia dis foto come from, EPA

Meanwhile, Iran Revolutionary Guard Corps (IRGC) don tok say Hamas political chief Ismail Haniyeh die from one "short-range projectile" wey dem fire from outside im guesthouse for Tehran on Wednesday.

Di paramilitary organisation tok say di projectile dey weigh about 7kg (16lbs) and e cause "strong blast", wey kill Haniyeh and im bodyguard last Wednesday.

Di Hamas leader bin dey visit di Iranian capital for di inauguration of President Massoud Pezeshkian.

Di IRGC don accuse Israel of designing and implementing di operation - wey US support.

Israel neva comment on Haniyeh's death.

Di IRGC account no follow wit reports for Western media, wey bin suggest say Israeli operatives plant explosives for di guesthouse.

Also Iran plus dia proxy for Gaza don blame di attack on Israel, and Israel neva comment.

62-year-old Haniyeh, dey widely considered as Hamas'overall leader and e play ogbonge role for one negotiations wey dey aimed at reaching ceasefire for di Gaza war.

Im death came just hours afta Israel claim say dem kill Fuad Shukr, di top military commander of Iran proxy for Lebanon, Hezbollah.

One Pentagon statement tok say di new deployments go "improve US force protection... increase support for di defence of Israel, plus ... ensure say di US dey prepared to respond to various contingencies".

Di deployments go include additional ballistic missile defense-capable cruisers and destroyers, dem tok.

High alert

For Tel Aviv seafront, di mood be like say e dey relaxed as bronzed bodies lie down lazily under beach umbrellas.

But na only few pipo dey in doubt say di Middle East dey very close to full- scale war.

Israel dey on high alert.

Several international airlines don suspend flights go di kontri.

Meanwhile, dem don send Israeli ministers go house dis weekend wit satellite phones in case of attack on communication infrastructure.

Earlier on Saturday, Israeli forces kill one Hamas operative for di West Bank.

Reports dey say dozens of Palestinians don die from strikes on Gaza in di last 24 hours - a reminder say Israel war for di region continue even as diplomats dey try stop am make e for no escalate.

Di US military don step-up deployments before, on 13 April wen Iran launch one attack on Israel wit drones and missiles. Israel plus dia allies bin shoot down almost about 300 drones and missiles wey dem fire.

Israel neva comment directly on di strike wey kill Haniyeh. But Prime Minister Benjamin Netanyahu say im kontri don deliver "crushing blows" to dia enemies in recent days, including di killing of Shukr for Beirut.

E warn Israelis say "challenging days lie ahead... we don hear threats from all sides. We dey prepared for any scenario".

Earlier, Pentagon tok-tok pesin Sabrina Singh say US no believe say escalation no go happun.

"I think we dey very direct for our messaging say certainly we no wan see see heightened tensions and we believe say one off-ramp dey here and dat na di ceasefire deal," Singh tok.

One Israeli delegation go travel go Cairo in coming days for negotiations to reach Gaza ceasefire and hostage release deal, Oga Netanyahu tok on Friday.

Hamas start di war with dia 7 October attack on Israel, wey kill 1,200 pipo.

Israel respond wit ongoing military operation for Gaza wey don kill almost 40,000 pipo, according to di Hamas-run health ministry.

Hamas political chief Ismail Haniyeh die from one "short-range projectile" wey dem fire from outside im guesthouse for Tehran, Iran Revolutionary Guard Corps (IRGC) tok.

Di paramilitary organisation tok say di projectile dey weigh about 7kg (16lbs) and e cause "strong blast", wey kill Haniyeh and im bodyguard last Wednesday.

Di Hamas leader bin dey visit di Iranian capital for di inauguration of President Massoud Pezeshkian.

Di IRGC don accuse Israel of designing and implementing di operation - wey US support.

Israel neva comment on Haniyeh's death.

Di IRGC account no follow wit reports for Western media, wey bin suggest say Israeli operatives plant explosives for di guesthouse.