Court sentence killer of Kwara State student Yetunde Lawal to death by hanging

Wia dis foto come from, SIKIRULAI ANDE
High Court for Kwara State, southwest Nigeria, don sentence di killer of Yetunde Lawal, Abdulrahman Bello, to death by hanging.
Abdulrahman bin chop accuse say im murder di 23-year-old student of Kwara State College of Education, Ilorin, for February 2025.
You go remember say police for Kwara State bin confam say dem arrest one 29-year-old man wey allegedly kill and pieces di body of di student of Kwara State College of Education, Ilorin.
Na Justice Hannah Ajayi sentence di accused pesin on Wednesday 31 July afta she find am guilty of di crime.
Justice Ajayi say evidence prove say Bello kill Yetunde so e go fit use am for money ritual and sell her parts.
According to di judge, di confession of love and plan to marry her na lie wey e tell am so e go fit invite am to im house to kill am.
Justice Ajayi set four suspects free afta she find dem not guilty.
How di mata take happun
Police for Kwara State say Yetunde Lawal bin don dey miss since 10th February. Na four days later dem find her bodi for di suspect house.
According to di tok-tok pesin for di Kwara State Police Command, SP Adetoun Ejire-Adeyemi, dem first receive alert of missing pesin from di victim papa.
"Our detectives begin follow di mata, dem track di phone of di girl sotey e lead dem to di suspect house and dem arrest am," na so she tok.
Late Yetunde na di first pikin of her family. Her papa and mama still dey alive. She bin dey final year for Kwara State College of Education, Ilorin, bifor di incident happun.
Security personnel find di dismembered bodi of Yetunde inside bowl for di suspect house.
Tori for town be say dem both meet online and begin friend till di suspect invite her over to im place for Olunlade area of Ilorin on 10 February 2025, di day wey e commit di crime.
Dis no be di first time wey court go dey sentence killers to death by hanging.
For June 2025, High Court for Lafia, Nasarawa State, bin sentence Oluwatimileyin Ajayi to death by hanging for di death of National Youth Service Corp member Salome Adaidu.
Justice Simon Aboki wey preside ova di case sentence di suspect on Thursday 26 June.
Di judgment find Oluwatemileyin Ajayi guilty of killing and dismembering (cutting to piece) di late Salome Adaidu.
Dem bin charge Ajayi wit one count of culpable homicide contrary to Section 221 of di Penal Code of Northern Nigeria wey dey punishable by death.
Police bin gbab Timileyin Ajayi wey say e be gospel singer wit Adaidu head on Sunday 12 January 2025 near one church for Orozo.









