Niger tanker explosion death toll rise to 86 as authorities bury victims

Read am in 5 mins

Di number of pipo wey die for di tanker explosion for Niger State, north-central Nigeria, don rise to 86.

Di tanker explosion happun for Dikko Junction, Gurara local goment area of Niger State on Saturday.

Na di Niger State Emergency Management Agency (NSEMA) put di number of deaths from di incident to 86.

Di number of pipo wey wound don also increase to 55. Tori be say one pesin die for di healthcare facility for Dikko.

Di Director General of NSEMA, Abdullahi Baba-Arah, say dem don bury di dead bodies wey dem recover.

Di burial happun through a coordinated effort by NSEMA, and di Gurara local goment area authorities and volunteers.

Dem bury 80 for inside mass grave for di Dikko Primary Healthcare premises, while dem hand ova di remaining five to dia families for burial around di town.

How di explosion happun?

Tori be say di mass burial dey veri challenging and e happun between 5 O'clock for evening and midnight.

Na mostly volunteers handle di mass burial and dem make sure say dem handle di victims properly.

According to NSEMA, dem dey join body wit relevant agencies so dat dem fit continue to manage wetin di disaster fit cause in future.

Dem dey aslo provide support for di pipo wey wound and di families of di pipo wey dey affected.

Meanwhile, di Niger State goment don give order say make dem no allow any vehicle wey dey come from di Maje axis to pass di Dikko Bridge.

Di National Emergency Management Agency (Nema) for statement confam say dia Minna Operations Office report one deadly tanker explosion wey happun on 18 January 2025, around 9:00 am along di Dikko-Maje road, opposite di Baddegi fuelling station for Suleja LGA.

"Upon receiving di report, di office bin mobilise dia stakeholders and activate di pipo wey dey closest to di incident site."

Na Head of Operations, Mr. Hussaini Isah, bin lead di MOO team, alongside search and rescue personnel and oda staff, wey go di scene near Dikko Junction for Gurara LGA.

"Di explosion bin happun wen one tanker wey dey loaded wit PMS crash and di drivers bin attempt to transfer di contents to anoda tanker.

During di process, di PMS wey pour for ground bin come into contact wit one generator wey dem bin dey use to transfer di petrol, e trigger massive explosion."

Govnor Umaru Bago give di order wen im bin visit di scene of di explosion around Dikko Junction, Gurara local goment area of Niger State.

Oga Baggo vex well-well sake of how some drivers dey drive anyhow. Im add say make dem dey drive pass under di bridge and make dem dey do proper U-turn.

Im beg di Sector Commander of di Federal Road Safety Corps to establish detachment for di area wey go make sure say dem go fit enforce di directive.

Im also beg relevant transport unions to join body wit am to make sure say drivers follow dis order.

Govnor Bago say di tanker explosion dey veri sad, im tank God say di fire no spread to oda communities wey dey nearby.

E beg Nigeria goment to take sharp-sharp action to complete di Minna-Suleja Road sake of say di delay dey contribute to di way pipo dey die evritime for dat area.

Im add say dem go send more doctors from Minna hospitals to assist to treat di victims wey wound, wey dey receive treatment for Suleja General Hospital.

More dan 15 shops burn for dis tanker explosion.

Tanker fire accident for Nigeria

Tanker fire no be new tin for Nigeria. Di West African kontri dey suffer from one tanker fire or di oda afta dis tankers fall.

Di tankers wey dey carry thousand of litres of mostly petroleum products like Premium Motor Spirit (PMS)popularly known as fuel dey fall sake of bad roads.

For October, 2024 one tanker wey dey carry fuel explode wey kill 153 pipo for Jigawa State, wey dey northern Nigeria.

Di police tok-tok person for di state, DSP Lawan Shiisu Adam, tell BBC Pidgin say di number bin increase to 153 pipo wey die, and about 100 pipo injure wia dem collect treatment for Aminu Kano hospital, Jahun, Nguru, Hadejia and Gumel hospital.

Dem bin do funeral prayer and bury some of di victims near where di accident happun sharp-sharp.

Di accident bin happun on around 11:30 pm afta di tanker bin comot from Kano to Nguru wey dey for Yobe state, di driver loose control of di truck wen e reach Majiya, one town for Taura Local goment Area for Jigawa State.

At least 28 pipo bin die and nobodi fit recognize dem afta dia death for fuel tanker explosion for Abuja/Lokoja highway inside north-central Nigeria.

Na few minutes after 8 O'clock on Wednesday morning for Felele axis of di highway wey dey for Lokoja, Kogi State na im di accident wey cause explosion happun.

Dis tanker explosion dey happun for different parts of the kontri and e dey cause many deaths sake of pipo wey dey nearby wey dey rtry to scoop fuel.