Why human beings dey craze for gold?

Gold

Wia dis foto come from, Getty Images

Gold don dey totori we human beings for a very long time, from di grave of ancient pharaohs, to di neck of Olympians.

In fact, e hard to tink of any oda tin for world wey fit totori pipo from all over like gold.

For everytin, from crown of kings and queens to Oscar statuettes, gold dey scream say e important.

E dey all over our culture, from golden tickets to golden disc. From golden handcuffs to comedy gold.

Gold bin originally form from di remains of stars and im physical properties dey extraordinary. E easy to bend into different shapes.

Wetin we call dis Video, Di value of gold: Why human beings dey craze for gold?

But if you torchlight gold wella, e get so many tins wey occur wey fit make pesin tink again.

Right from way back time, pipo and kontris don kill for gold.

Gold and war dey go togeda. E don cause some kain wars like di South Africa brutal Boer War of 1899 to 1902 and during World War II wen Nazis and Japan pipo steal plenty gold wey dem neva recover reach today.

Wen kontris no dey steal gold, tiffs sef dey corner di precious metal for demsef.

Di biggest armed robbery wey happun for UK na di Brinks-Mat robbery for 1983, wia six men attack one wearhouse near Heathrow Airport.

Dem escape wit 6,800 bars of gold wey dem pack for 76 cartons.

Till today dem no fit catch most of di gang members.

Di believe be say dem melt di gold bars, mix am wit copper to hide wia e from come.

Gold mining dey cause serious air pollution and wey dem no regulate am properly e fit contaminate rivers.