Shooting for Jehovah Witness hall leave plenti pipo dead for Hamburg

Police wit guns

Wia dis foto come from, Reuters

Plenti number of pipo don dey killed for one shooting wey happun for Jehovah Witness meeting hall for di north German city of Hamburg.

Police say di gunman act alone for di Thursday attack, and dem think say e don die. Dem add say, as yet, "no reliable information dey on di motive".

Di gunman na former member of di religious community wey dey between di age of 30 and 40, Der Spiegel magazine report am.

Dem neva fit identify di victim and work still continue for di crime crime scene.

Police say dem find one pesin dead for di scene wey dem believe fit be di perpetrator and investigations dey continue.

Dem call police around 21:15 (20:15 GMT) to report say dem fire shot for di building, police spokesman Holger Vehren tok.

Officers wey go in find pipo wey "fit don dey seriously injured by firearms, some of dem don die from di shooting", e tok.

"Di officers also hear one shot from di upper part of di building and go upstairs, wia dem also find one pesin. So far e no get indications say any perpetrators dey run comot."

Video appear to show suspect dey shoot through di window

Wetin we call dis Video, Hamburg shooting: Armed police storm one building

Lara Bauch, one 23-year-old student wey dey live nearby, tell di DPA news agency say "na about four bursts of gunfire - several shots dey fired in each burst - wit gaps wey last roughly 20 seconds to one minute".

She say dat from her window she fit see one pesin dey run from di ground floor to di first floor. "Di man bin dey wear dark cloth and move fast," she add.

Dem send one alert on di federal warning app, NINAwarn, at around 21:00 (20:00 GMT) dey tell locals say "one or more unknown perpetrators shoot at pipo for one church".

Dem tell resident nearby make dem no comot from dia homes as police operation dey go on.

Video show police dey escort pipo out of di meeting hall, some to ambulances.

Hamburg Interior Minister, Andy Grote, tok on Twitter say police special forces and one large number of officers don dey deployed to di scene.

Im tok say police neva yet identify di victims and work at di crime scene dey continue.

"All we know be say plenti pipo don die hia, plenti pipo injure, dem don carry dem go hospital, “ Oga Vehren tok.

Di reasons behind di shooting "still no dey completely clear".

Shooting for Jehovah Witness hall for hamburg

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Forensic experts don dey work at di scene through di night
Dem also deploy bomb disposal unit to di scene

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Dem also deploy bomb disposal unit to di scene

On Friday morning, German Chancellor Olaf Scholz describe di shooting as a "brutal act of violence", say im thoughts dey wit di victims and dia relatives.

For one statement, di Jehovah Witness community for Germany say dem dey "deeply saddened by di horrific attack on im members for di Kingdom Hall for Hamburg afta one religious service".

Hamburg Mayor Peter Tschentscher don tok about im shock and offer im condolences to di families of di victims.

Forensic experts don dey work for di scene through di night. Dem fit still see dem inside dia white suits inside di brightly lit interior of di meeting house.

Tori be say pipo bin gada, possibly for Bible study, wen di shooting start at around 21:00 local time.

Police don appeal to di public not to share assumptions or to spread rumours.

Jehovah Witnesses na members of one Christian-based religious movement.

Dem found di denomination for di USA towards di end of di 19th century, under di leadership of Charles Taze Russell. Di headquarters of di movement dey for New York.