Train accident in Lagos: Six pesin die, several injure as train crush goment staff bus for Lagos

Lagos train accident: Two pesin die, several injure as train crush goment bus for Lagos
Read am in 4 mins

Authorities don confirm say at least six pipo die and several pipo injure as one moving train jam one Lagos State goment bus for PWD bus stop for di Ikeja area of Lagos on Thursday morning.

Govnor Babajide Sanwoolu of Lagos give di update wen e dey brief tori pipo after visiting di hospital wia di victims dem dey.

According to di govnor, di preliminary report show say na driver error cause di accident.

Di driver wey survive di accident now don dey police custody for further investigation.

E reveal say out of di 85 pipo wey dey inside di bus, six pipo die while 29 get 'serious injury'.

42 odas get 'moderate injury' and di rest eight get 'mild injury'. E tok.

"Di State goment staff bin dey try cross di PWD/Shogunle rail crossing while di train wey dey come into Lagos from Abeokuta trap di bus ontop rail," Di Lagos State Traffic Management Authority (LASTMA) tok-tok pesin, Adebayo Taofiq confirm di incident to tori pipo.

Two NRC flag Officers bin reportedly try to stop di driver of di bus from crossing but dem say di driver ignored di directive and drive into di rail.

Many fotos from di accident too dey gory.

Lagos govnor declare three days mourning

Lagos State Govnor Babajide Sanwo-Olu don express deep shock and sorrow ova di accident and declare three days mourning.

E say pipo of di state civil service go work half day tomorrow and e direct flags to fly at half mast for di state.

Di govnor tok-tok pesin Gboyega Akosile for one statement say di govnor send im condolences to di families of pipo wey lose dia lives for di accident.

"Di govnor, wey dey sad sake of di event, send im deep condolences to di families of pipo wey lose dia lives for di accident, im pray say God go grant dem eternal rest," di statement tok.

Di govnor say di bus dey carri staff of di Lagos State Goment wey dey serve in different capacities.

Sanwo-Olu urge pipo to pray for deceased families and also say prayer of mercy and protection for di state.

"My thoughts dey wit di victims and dia families during dis difficult time."

Di govnor also tank Lagosians wey join di State first responders for search and rescue operation. E tok say di true spirit of Lagos gazz dey sustained at all times.

"A big thank you to well meaning Lagosians wey immediately join for rescue efforts. Our first responders and emergency services dey on ground and we go share more information shortly," e tok.

Minister order investigation

Train accident in Lagos: At least three pesin die, several injure as train crush goment bus for Lagos

Nigeria minister of aviation Hadi Sirika don direct di Nigerian Safety Investigation Bureau experts to commence immediate investigation into di accident.

For one statement by James Odaudu wey be special assistant to di minister, Sirika say di accident dey unfortunate and assure di public of di capacity of di Nigeria Safety Investigation Bureau to unravel di immediate and remote causes of di accident and proffer ways to prevent such tin for future.

Di minister call for di cooperation of members of di public as investigation by di NSIB dey start.

Sirika tok sorry to di goment and pipo of Lagos State especially pipo wey lose dia loved ones for di accident.

Di minister also pray for di quick recovery of pipo wey injure for di accident.

Blood donation dey go on

Blood donation don dey go on for di Lagos State University Teaching Hospital wey dem rush di victims to. Jubril A Gawat, di Senior Special Assistant on new media to Govnor Sanwo-Olu na im yarn dis one for im Twitter page. E say oda hospitals wey di donation dey go on na for General Hospital Gbagada, Lagos State Accident and Emergency Centre toll gate, General Hospital Lagos Island, and Folarin Coker Staff Clinic Alausa Ikeja.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

Train accident for Nigeria

Train accident for Nigeria na source of concern for pipo of di kontri and beyond.

For December 2022, police bin confam di death of one woman for train accident for Abuja, Nigeria Capital.

Tok-tok pesin FCT Police Command, Josephine Adeh for statement say di "unfortunate incident of Rail/ motor fatal accident happun for di Chikakore axis for di Bwari Area council of the FCT".

She say medical practitioners confam di death of di victim and dem don start Investigation.

Eyewitnesses say di woman bin dey drive cross di rail track wen di train jam her car komot.

Her family say she bin dey on her way to work. Her house na just about three minutes from wia di accident happun.

For September 2020, one pesin lose im life and one pesin injure for one train accident wey happun for Oshodi are of Lagos.

Officials tok say three vehicles dey involved for di crash of di Lagos State Emergency Management Agency (LASEMA) confirm di tori on social media.

Dis na some of di fotos wey we fit share:

Train accident in Lagos: At least three pesin die, several injure as train crush goment bus for Lagos

Wia dis foto come from, Empics

Train accident in Lagos: At least three pesin die, several injure as train crush goment bus for Lagos
Train accident in Lagos: At least three pesin die, several injure as train crush goment bus for Lagos
Train accident in Lagos: At least three pesin die, several injure as train crush goment bus for Lagos
Train accident in Lagos: At least three pesin die, several injure as train crush goment bus for Lagos
Train accident in Lagos: At least three pesin die, several injure as train crush goment bus for Lagos