You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Rivers State House of Assembly members shun Govnor Fubara invitation to meet
Di meeting between Rivers State Governor Siminialayi Fubara and di 27 lawmakers no hold for di Rivers State Government House as di lawmakers no show.
Di state through di Secretary to di State Goment bin invite di lawmakers to Goment House, to see how dem go join bodi implement di Supreme Court judgement.
For one letter from Tammy Wenike Danagogo wey be Secretary to di State Goment (SSG), e say Govnor Fubara dey committed to foster legislative-executive collaboration for di progress of Rivers State.
"I hereby write in furtherance of di Excellency promise for my letter dated 5th March, 2025 to notify you say im Excellency don receive di Supreme Court judgement, and direct me to invite you and your colleagues – di Honourable members of di Rivers State House of Assembly, to meeting," di letter bin tok.
For February, Supreme court, bin stop di Central Bank of Nigeria and di Accountant-General of di Federation from releasing funds to di Rivers State goment until di Rivers House of Assembly dey properly constituted in accordance wit di 1999 Constitution.
Di court also declare Martin Amaewhule as di legitimate Speaker of di State Assembly afta Fubara don already present di state budget to Victor Oko-Jumbo faction of di State Assembly
But a lawmaker, Lolo Opuende Isaiah wey dey represent Akuku Toru Constituency 2 bin release video for social media wia e say time don come for evribodi to 'dey im dey'.
Di lawmaker say di same way di govnor say di letter from di lawmakers wey dem tell am to represent di 2025 budget before dem no dey properly sent to am, na di same way dem too want di govnor to send im own letter to dem properly, odawise, make evribodi dey dia dey.
Instead, di lawmakers hold sitting for di Assembly Quaters and issue warrant of arrest on di Chairman of di Rivers State Independent Electoral Commission RSIEC; Justice Adolphus Enebeli Rtd.
Dis dey come after di expiration of di 72-hour ultimatum for di RSIEC Chairman to appear before di House.
Enebeli bin don fix 9 August, 2025, to conduct a fresh local government election for di state following di Supreme Court verdict wey cancel di October 5, 2024 local goment poll for di state.
Di Amaewhule-led Assembly vow to probe di conduct of Enebeli regarding di conduct of di annulled local goment election last year.
How di political kassala start?
Wahala start afta Govnor Siminalayi Fubara and im former political godfather wey be di immediate past govnor, Nyesom Wike, bin get issue. E no dey clear exactly wetin cause dia fight.
But majority of di members of di Rivers State Assembly wey dey loyal to Wike bin join body to fight Fubara, and dem even make attempt to impeach am from office.
Di matter even lead to explosion for di Assembly complex and di demolition of part of di complex by di govnor.
Eventually, di Wike loyalists announce say dem don comot from di Peoples Democratic Party (PDP) and say dem don join di All Progressives Congress (APC), so Fubara insist say dia seats for di Assembly don dey vacant based on wetin constitution tok. Sometin wey di lawmakers don deny.
Di constitution tok say elected pesin wey leave im party go also vacate di position wey e win thru dat party, unless if clear division dey for di party.
Govnor Fubara and im faction argue say no division dey for PDP wey suppose cause di oda lawmakers to comot, so dia seats don automatically dey vacant.
Di govnor match im threats wit action wen e present di 2024 budget to only four members of di State Assembly led by Edison Ehie as Speaker dat time.
Fubara later appoint Edison Ehie as im Chief of Staff, and Victor Oko Jumbo replace am as Speaker.