You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Canada wan reunite 10,000 immigrants families through PGP program
Immigrants wey don become Canadian citizens and di ones wey be permanent residents for Canada fit bring dia parents and grandparents come live and work for di kontri under di 2025 Parents and Grandparents Program (PGP).
Di Immigration, Refugees and Citizenship Canada (IRCC) wey announce dis informate for dia website tok say dis year, dem plan to accept up to 10,000 applications, from potential sponsors wey bin submit interest forms under di PGP program for 2020.
Di Canadian goment add say, di parents and grandparents of dose wey no submit di 'interest to sponsor form' for 2020, still fit come Canada for extended visit, through di super visa pathway.
By applying for di super visa, dem go fit visit for up to five years at a time and extend dia stay wen dem dey Canada.
As at 5 February, di goment say dem don begin process di PGP program applications for dose wey dey outside Quebec.
Di Canadian goment no announce wen dem go send di invitations, but dem promise to release more details in di coming months.
Wetin be di super visa
IRCC say di super visa dey available for permanent residents wey no submit di interest form and dem still wan reunite wit dia parents and grandparents for longer period of time
Di super visa go allow parents and grandparents to visit dia children or grandchildren for five years at a stretch - e also provide multiple entries to Canada for up to 10 years.
IRCC say dem recently change di health insurance requirement for di super visa to make am more accessible.
However, to dey eligible for dis super visa, di sponsor or host gatz be at least 18-year-old pesin wey dey live for Canada.
E gatz be di child or grandchild of di pesin wey im dey invite.
Di sponsor gatz be Canadian citizen, permanent resident or registered Indian. E gatz meet or pass di minimum necessary income.
Di parent or grandparent wey dey apply for di super visa gatz provide document wey show say di host na Canadian citizen, permanent resident or Certificate of Indian Status.
E gatz show authorities di letter wey di host take invite am, how long e go stay, plus promise of financial support from di host.
Also, pesin wey wan apply for di super visa gatz dey live outside Canada wen dem submit dia application for di visa.