'My portfolio too large, make I no chop well belleful' - Nigerian actress Beverly Osu

Wetin we call dis Video,
'My portfolio too large, make I no chop well belleful' - Nigerian actress Beverly Osu
    • Author, Faith Oshoko
    • Role, Journalist
    • Reporting from, Lagos

Nigerian actress Beverly Osu for dis exclusive interview wit BBC News Pidgin tok about her mental health advocacy, di film industry for di kontri and why she bin dey depressed wen she comot for Oloture movie set.

She say her upbringing, di society wey she dey live in and di job wey she dey do na wetin make am start to dey advocate for mental health.

"I don see say many pipo don dey neglect am, you understand. Many testimonies wey I feel tell una: 'Ah Beverly, di way wey you dey carry yoursef, I just like am. Oh Beverly, dat tin wey you tok for dat day make I know mysef bifor I know oda pipo. You know, I dey see all dose testimonies and e dey give me joy oh, e dey give me joy, you understand. Make e no be say my work on earth dey in vain, becos I no go stop until I accomplish my purpose," she tok.

Beverly say she dey put in so much work and she go like to enjoy di royalties of di movies wey she don do in di past.

"I go like make I dey chop my money now for di tins wey I do wen I dey my teenage years. Bicos if you check am, my portfolio too large, make I no chop well belleful," di actress tok.

She say wen she comot for Oloture set, she bin depress for three months sake of identity crisis.

Na Mobolaji Olatunde shoot and edit am