Efa Iwara tori how e go from being a bored musician to one of Nollywood eligible 'manchelor'
Efa Iwara tori how e go from being a bored musician to one of Nollywood eligible 'manchelor'
Nollywood star, Efa Iwara journey into di industry no be like di typical one.
For dis interview with BBC Pidgin, E tok about im first hustle with rap career until im decide to go for feem audition
Although e say na boredom push am to discover acting, e take am ten years to develop im acting skill.
Efa Iwara dey inside series like Ajoche, Men's Club, Rumours Have It and for feems like A Naija Christmas, Finding Hubby and Rattle Snake among plenti odas.
E also yan about im personal life and which kain woman fit make am give up im bachelor status.






