Who go be Kamala Harris running mate and under wat conditions?

Wia dis foto come from, Getty Images
Since wen U.S. President Joe Biden don end im re-election campaign to endorse Vice President Kamala Harris to take im place as di Democratic Party nominee, plenti kwesion don dey show face.
One big kwesion na who go be running mate to Kamala Harris as she dey front to become di Democratic candidate wey go face opponent Donald Trump for di US Election.
Di whole mata wey dey happun for di election dey come four months bifor Americans go decide who go be dia new president for di White House.
Kamala Harris officially sign di form wey she use declare her candidacy for di position of di President of US. She sign di form on 27 July 2024.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Who go be Kamala Harris running mate?
Na different situations fit play out for di next coming days and weeks,as to how Kamala Harris go pick who go be her running mate.
Di Republican Donald Trump don already pick JD Vance as im running mate and all eyes dey for di Democratic to choose who go dey di ballot in di coming election.
Kamala Harris go gatz pick her running mate by di time wey di Democratic party delegates go vote next month for dia convention wey go hold wia dem go confam who go dey dia presidential ticket.
By history, dem dey always pick vice president base on how dem go complement di presidential candidate.
End of Di one wey oda users dey read well well
But who Kamala Harris go like pick? E get some names wey don already dey spotlight and fit dey considered to be running mate.
Pennsylvania Govnor Josh Shapiro

Wia dis foto come from, Getty Images
Pennsylvania Govnor Josh Shapiro don get high approval ratings since dem elected am for 2022.
Di govnor, wey serve as di state attorney general bifor, don work across party lines during im tenure.
Im make national headlines last year afta e quickly rebuild one collapsed bridge for Philadelphia highway. Na major political victory for any first-term govnor.
Di speedy repair bin receive plenti hailing from pipo wey see am as di perfect infrastructure mata for any potential candidate wey wan contest for 2028 presidential election.
Mark Kelly, Arizona Senator

Wia dis foto come from, Getty Images
Di former astronaut and Navy combat pilot dey strong for im stand for border issues and how e dey criticise di Biden administration. Dat fit cat di eye of voters.
Di Democratic superstar wife Gabby Giffords was shot for one mass shooting and dat fit give im personal story a strong wing.
Di former House congresswoman dey seriously wounded and she become one of di leading voices on gun safety laws.
Wit gun violence as one major campaign issue for Democrats, Mr Kelly personal story fit go well wit voters.
Michigan Govnor Gretchen Whitmer

Wia dis foto come from, Getty Images
Gretchen Whitmer na two-term govnor of Michigan, and she dey popular for di Midwest Democrat wey many pipo believe say go run for president for 2028.
She don campaign for Mr Biden in di past and she no dey shy about her political aspirations.
She tell di New York Times say she wan see Generation X president for 2028, but she stop to suggest say she fit fill dat role.
For 2022, she bin lead one campaign wey leave Michigan Democrats for control of di state lawmaker and di govnor seat.
Dat kain political control bin allow her to make some policies wey include to protect Michigan abortion access and di passage of gun safety measures.
Transportation Secretary Pete Buttigieg

Wia dis foto come from, Getty Images
E no be secret say Transportation Secretary Pete Buttigieg get presidential aspirations.
E contest for president for 2020 and im dey as one of di Biden administration best communicators.
Mr Buttigieg don manage some public crises during im time as transportation secretary.
E help to oversee di goment response to di East Palestine train derailment for Ohio, di Baltimore Bridge collapse and Southwest Airlines scheduling crisis for 2022.
Illinois Govnor JB Pritzker

Wia dis foto come from, Getty Images
JB Pritzker wey be di govnor of Illinois don raise im profile in recent years by going afta Trump and to defend Mr Biden.
Di billionaire businessman dey quick to post criticism of Trump for social media.
Afta di debate, e call Trump "liar" and say e be "34-count convicted pesin wey only care about imsef".
Like Ms Whitmer, Mr Pritzker get track record of completing agenda items for Democrats to-do lists ontop issues like abortion rights and gun control.
Oda possible candidates dey?
Di list of potential nominees dey long beyond dis Democrats, as di party don develop list of possible future presidential candidates.
Kentucky Govnor Andy Beshear, two-term Democratic govnor for veri conservative state, don earn growing national attention since im re-election last year.
Maryland Govnor Wes Moore find imsef for di spotlight in recent months following di collapse of di Francis Scott Key Bridge for Baltimore.
Senators Amy Klobuchar and Cory Booker don contest for president for di past and get some name recognition among Democrats.
Georgia Senator Raphael Warnock, wey win one closely contested Senate race for swing state, also dey among dose wey dem mention as potential running mate for Kamala Harris.














