Amaechi Muonagor don die - Family confam

Ogbonge Nollywood veteran actor, Amaechi Muonagor don die.

Im cousin Tony Muonagor wey pipo sabi as Tony Oneweek confam im death to BBC.

E die at di age of 62 afta battle wit kidney related issues, diabetes and stroke.

For 2023, e suffer from one stroke wey lead to partial paralysis of im left leg.

Di veteran actor death come just days afta e cry out for financial assistance on social media to enable am pay for kidney transplant.

One video wey bin go viral for social media earlier dis month show di actor on top bed wit bandage on im chest, e no fit tok very well.

Na anoda actor, wey siddon near am, dey explain say Oga Muonagor need money to pay for kidney transplant.

Di news of im death dey come as Nigerians still dey mourn di death of Nollywood star John Okafor, wey pipo know as Mr Ibu, wey bin also need medical help.

Di Nollywood comedy legend bin appear for many Nigerian movies. including Aki and Paw Paw, wey be one of im most famous roles wia e play di father of two mischief-making, over-exuberant teenagers.

Many of im fans don dey mourn im death on social media.