Usyk vs Fury 2 - all you need sabi

Usyk vs Fury 2

Wia dis foto come from, Getty Images

Read am in 4 mins

Oleksandr Usyk and Tyson Fury go enta ring togeda again on 21 December for Saudi Arabia.

Di rival heavyweights bin fight six months ago for Riyadh - Usyk beat Fury wit split decision.

Dat night bin dey historic for Usyk wey become di modern era first four-belt heavyweight champion and dem go do am again.

Di big question na weda Fury go fit revenge im only loss or Usyk incredible, stainless career go continue?

Evritin you need sabi about di WBA, WBO and WBC heavyweight world title fight dey inside dis tori.

Wen be Usyk vs Fury 2 and what time?

Ringwalk timings for Saudi get as e be, for di past 12 months. Some fights don start afta midnight while odas don start closer to 22:00.

Organisers for Riyadh dis time dey eye for di earlier end of di time.

Di first fight dey set to start at 17:00 WAT.

Dem dey target Usyk and Fury ringwalks for 23:15, meaning di fight fit probably startaround 23:30.

Who dey Usyk vs Fury 2 undercard and wetin be di running order?

Oleksandr Usyk vs Tyson Fury 2 - WBC, WBO & WBA heavyweight titles

  • Serhii Bohachuk v Ishmael Davis - light-middleweight
  • Moses Itauma v Demsey McKean - heavyweight
  • Johnny Fisher v Dave Allen - heavyweight
  • Peter McGrail v Rhys Edwards - featherweight
  • Isaac Lowe v Lee McGregor - featherweight
  • Daniel Lapin v Dylan Colin - light-heavyweight
  • Andrii Novytskyi v Edgar Ramirez - heavyweight

Wetin be Usyk vs Fury 2 fight week schedule?

  • Wednesday - open workout
  • Thursday - news conference
  • Friday - weigh-in from 18:00

How Usyk and Fury records be?

Usyk vs Fury

Just like di first fight, Usyk vs Fury 2 na contest of fine margins.

Usyk, wey be 37 years, don collect all di belts for heavyweight and cruiserweight.

Ukraine golden boy dey unbeaten in 22 fights wit 14 knockouts - im shine well-well for im last fight.

Usyk best attribute na im boxing brain and fantastic movement. Di victory ova Fury na di best win of im career, but Usyk don also beat Anthony Joshua, Daniel Dubois and Tony Bellew.

Fury, wey be 36 years, get big reach and height advantage, na six inches dey separate di two tall heavyweights.

A clever person fit suggest make Fury put im seven-inch reach advantage to use for di rematch.

Di loss to Usyk na Fury first in 16 years as a pro as im record change to 34 wins, one defeat and one draw.

Fury bin hold evri title at heavyweight, but no be di same time. Im best wins na ova Deontay Wilder, Wladimir Klitschko and Dillian Whyte.

As both heavyweights dey near 40 years of age, miles for clock fit play a big part for di di rematch.

Usyk dey fresher, for di pro game at least, im don compet in 14 fewer fights pass Fury 36 bouts.

Plus say, Fury don box 242 rounds compared to Usyk 189.

Who be di judges for Usyk vs Fury 2?

Americans Patrick Morley and Steve Weisfeld go score di fight along wit one Puerto Rico judge Gerardo Martinez.

Which belts Usyk vs Fury 2 dey fight for?

Usyk go defend im WBA, WBO and WBC heavyweight belts.

Unlike di first fight, di IBF belt now belong to Daniel Dubois afta Usyk bin dey forced to drop am afta im victory ova Fury.

E mean say dis rematch no be for di official undisputed heavyweight championship.

Usyk Ring Magazine heavyweight title also dey up for grabs.

Wetin happun di first time Usyk and Fury fight?

Usyk become di first undisputed heavyweight champion in almost 25 years for May. Lennox Lewis na di last pesin to achieve dat status.

Di highly anticipated bout wit Fury deliver in all respects, e provide all di drama and quality fans bin hope for.

Afta im shine for di opening rounds, tins change as Usyk begin enta im rival small-smal.

Usyk bin dey patient, im bin dey invest in body shots, and im almost stop Fury for di ninth round.

Referee count for Fury for di 12th and final round and remarkably im recova to win di round.

Di scorecards read 115-112 and 114-113 for Usyk, a third judge score am 114-113 to Fury.