Wetin go huppun now wit Man Utd and Rashford?

Marcus Rashford

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Marcus Rashford afta im score di first goal of Ruben Amorim tenure for Manchester United against Ipswich on 24 November
    • Author, Simon Stone
    • Role, Chief football news reporter
  • Read am in 6 mins

Marcus Rashford na one of di popular players for Premier League.

Im don make 426 appearances for Manchester United and im dey 12th for di club all-time scoring list wit 138 goals.

Di 27-year-old don win both di FA Cup and EFL Cup twice. Im also don win di Europa League. Im get 60 England caps.

Outside football, dem award am MBE for 2021 for im work around child poverty.

But now im career get as e be sake of tori wey dey fly up and down say im days for United dey numbered afta im coach drop am for di Manchester derby.

How we reach here?

On 18 July 2023 United confam say Rashford don sign new contract wey go keep am for di club until 30 June 2028. Dis end all di tok-tok about im future as Rashford previous deal bin dey due to expire in 12 months and im already don dey linked wit a number of major European clubs.

Di move make sense. Rashford bin just score a career-best 30 domestic goals during di 2022-23 season and im still only be 25.

Afta three games witout a goal, im score di opener for wetin turn out to be a 3-1 defeat for Arsenal on 3 September.

Im no score again for anoda 13 games as United poor form under Erik ten Hag begin.

For January di coach drop Rashford for dia FA Cup trip to Newport County afta e miss training sake of illness afta im bin spend longer time pass wetin dem approve for am for one authorised trip to Belfast. Foto comot of am wia im dey enter nightclub wia im bin drink tequila.

Although Rashford score di first goal of Ruben Amorim reign afta only 81 seconds for Ipswich on 24 November, di new United head coach don admit say di central striker no be di 27-year-old best position. Although Rashford bin start three games and be substitute for three of Amorim first six games in charge.

But, crucially, im bin dey bench for di midweek Premier League trip to Arsenal and di home game wey follow against Nottingham Forest on 7 December. Im start for di Europa League against Vitoria Plzen on 12 December but dem replace am afta 56 minutes wen United dey 1-0 down. Dem go on to win 2-1.

Dem drop am along wit Alejandro Garnacho for di Manchester derby. Afta di game, Amorim explain why: "Di performance for training, di way you eat, di way you push your team-mates - evritin dey important for di beginning of somtin. Wen pipo for your club dey lose dia jobs, we gatz put di standards really high."

Why pipo dey criticise Rashford?

At some point, evri manager get to make big calls. weda you like am or not, di outcome go end up to be how pipo see am .

Sir Alex Ferguson time for United dey littered wit major decisions - from axing Paul McGrath and Norman Whiteside but keeping Bryan Robson for di start of im reign, to letting Paul Pogba leave at di end.

Amorim know exactly wetin di fallout go be from im decision to leave Rashford out.

If United bin lose for Manchester City, pipo for ask many questions about di wisdom of just having only Joshua Zirkzee for bench as attacking player. But dem no need to. Thanks to Amad Diallo, dem win.

"Today we prove say we fit leave anybodi out and win," Amorim tok afterwards. Dat na big stick to take beat im players.

Rashford na realist. Im go know di hand writing for wall for am. E dey fair to say for di past 18 months - or for all but di 2022-23 season since November 2021 im score only twice for im last 28 appearances of di campaign wey Ralf Rangnick end in charge - im form dey below di standards of wetin im dey capable of.

Many pipo don criticise am well-well for im work ethic - and by some for im off-field behaviour, wey include trip to United States during di November international break.

Although some pipo dey argue say di way dem dey single out Rashford no fair. But dat side of im life no go change. Im need to deliver - and many times, im no dey deliver.

Who fit afford Rashford?

Rashford na one of United highest earners, im basic wage reach £300,000 a week. Only a small number of clubs fit afford dat salary and, for a variety of reasons, some of dem no dey market.

For Spain, evribodi know Barcelona financial issues. Real Madrid already struggle to find di right attacking combination from Kylian Mbappe, Vinicius Jr and Jude Bellingham.

Atletico bin pay big money to Manchester City for Julian Alvarez just bifor di summer transfer deadline.

For England top clubs, Manchester City and Liverpool na a bit of a stretch, even wit City poor form. Arsenal need a central striker - and Rashford no like to play dia. Chelsea dey like dem don spend enough. Tottenham dey inconsistent but e dey hardly likely for dem to drop dia skipper Son Heung-min, wey dey play for left.

Many times pipo don mention Paris St-Germain as a possible destination on a number of occasions down di years, but di French giants don always comot dia bodi from dat kain tok.

United don previously dey linked wit Randal Kolo Muani. However, even a swap deal dey questionable sake of say Rasmus Hojlund don impress as Amorim first choice for di lead attacking role.

Di Saudi Pro League fit make a big statement by signing such a recognisable figure from di Premier League wey be 27years. However, di feeling na say Rashford no buy dat kain plan.

A loan involving some kain wage contribution dey possible. But United don repeatedly speak of dia tight profit and sustainability rules (PSR) situation, as well as dia commitment to abide by di rules, so paying to let a high earner play for someone else go dey counter-productive.

Rashford fit stay for United?

Anybodi wey dey old enough to remember di Wayne Rooney saga from October 2010, wen im drop in a transfer request, wey Ferguson publicly finish am. And den go on to sign a new contract, all within less dan a week, go know say notin dey impossible for United.

Dis mata get three main points.

First one, na weda Rashford go meet Amorim demands? Dat, really, go be di easy bit - certainly di effort suppose dey non-negotiable. I dey tok about di effort Amorim dey demand, no be wetin di social media observers tink.

Second one, na if, im go fit di system? Dis part dey a bit more tricky. Rashford like to play wide and cut in. But no slot for dat for Amorim system.

Di coach don already tok say Rashford no dey ideally suited for a typical number nine role, wey go leave am wit either wing back (unlikely) or inside forward.

Di inside forward go require a lot of work, wey United no get wit dia current schedule. But if Hojlund dey hold di ball up, using Rashford pace to run na a viable alternative.

If Amorim want im team to dominate possession, e dey less valuable, especially if dem dey move into a higher area for pitch on a more consistent basis.

Di third option na to accept make di team dey use am as impact substitute. As Rashford dey approach di peak point of im career, going down dat route dey difficult to see am happun.