Birthsafe: 'With di right care, women fit get Ice-cream births'
- Author, Karina Igonikon
- Reporting from, Port Harcourt
Sake of di concern she get for di high infant and maternal mortality rate for Nigeria, dis Nigeria general practice doctor don develop ogbonge ways to ensure safe child births for both mama and pikin.
Dis protocol ginger Dr Idara Umoette to develop Birthsafe, to help care for women before dem get belle, during di period of pregnancy to make sure say dem born di pikin safely wit mama alive, pikin alive and proper care after dem born to avoid complications for both di mama and pikin.
Wit dis kain care, Dr Umoette alias Mama Birthsafe don help many pipo wey dey suffer from infertility issues achieve pregnancy and dis she say concern both di man and di women involved.
"To achieve pregnancy require equal contribution from both di man and di woman. But becos say di physical evidence of pregnancy dey mostly seen on di woman, majority of di times, di blame for infertility dey on di woman, but e go surprise you to know say more often than not, di reason wey make some couples neva get belle dey with di man."

Dr Idara say from experience as she dey work wit couples wey dey face dis challenge, she identify stress as a major factor wey dey cause infertility among couples, weda na wit di man or di woman.
"If you remove di stress factor, for most couples dem go achieve pregnancy. If dem man dey well rested and di women no get anytime wey go dey worry her, e no dey tay, dem don get belle.
"So wen we see couples wey dey battle infertility, I go just tell dem go on a honey moon. Take your wife out make una go relax for three weeks, for majority of dem, by di time dem return dem go say, ' ah doctor, my wife don get belle o!'"
Filmed and edited by Idara Monday






